9
Doz Wey Kom Back From Babilon
Dem rite Israel pipol name akordin to dia family for Israel kings history book. Dem karry Judah pipol go sofa for Babilon, bikos of dia sins.
Doz wey first kom back to dia land na: di priests, Levi pipol, doz wey dey work for di temple and some few Israel pipol.
Some of di pipol wey kom back to Jerusalem na from Judah, Benjamin, Efraim and Manasseh tribes.
Utai family dey among di ones wey kom back to Jerusalem. Utai na Ammihud pikin and na Omri bi en grand-papa. Na Imri wey Bani born, bi Omri papa and na Perez wey Judah born bi Bani papa.
Odas still kom back from Shilon family and dem bi Asaya wey bi di first-born and en sons.
From Zera family,
Jeuel and en family kom back too.
Na 690 family for Judah kom back to Jerusalem.
Doz wey kom back from Benjamin tribe na:
Sallu wey Meshullam born. Meshullam na Hodevah pikin and na Hassenuah bi Hodevah papa.
Ibneaya wey Jeroham born naim bi Hassenuah papa. Jeroham papa na Elah wey Uzzi born and na Mikri bi en grand-papa. Meshullam wey bi Shefataya pikin, na Reuel wey Ibnijah born, bi en grand-papa.
Na 956 family kom back from Benjamin tribe and dem rite dia names for di rekord book. All of dem na leader for dia family.
Di Priests For Jerusalem
10 Di priests wey kom back to Jerusalem na:
Jedaya, Jehoiarib, Jakin, 11 and Zabud wey bi di leader for God Temple. Na Hilkaya wey Meshullam born bi en papa. Zadok wey bi Meraiot pikin, na-im bi Meshullam papa. Meraiot na Ahitub pikin. 12 E still get Adaya wey Pashhur pikin Jeroham born and na Malkijah bi Pashhur papa. Adiel pikin, Priest Massai still dey and na Jahzerah bi en grand-papa. Na Meshullam born Jahzerah and na Meshillemit wey Imma born, bi Meshullam papa. 13 Dem bi 1,760 priest wey kom back and dem bi leader for dia family. Dis men dey work well-well and na dem dey do God work for di temple.
Levi Pipol For Jerusalem
14 Levi pipol wey kom back to Jerusalem na: Shemaya wey Hasshub born, wey Azrikam born, wey Hashabaya born wey kom from Merari tribe; 15 Bakbakkar; Heresh, Galal and Matanaya wey Mikah born and dis Mikah, na Asaf grand-pikin wey Zikri born. 16 E still get Shemaya pikin, Obadaya and na Galal wey Jedutun born, bi en grand-papa. Berakaya wey Asa born, na-im bi Jedutun papa. Na Elkanah bi Asa papa and na Netofat pipol land dem dey stay.
Di Temple Guards
17 Di temple guards wey kom back to Jerusalem na:
Shallum, Akkub, Talmon, Ahiman and dia brodas. Na Shallum bi dia leader. 18 Till today, na dia family dey guide di east side for di king gate. Before-before, na dem dey guide di gate wey dey for Levi pipol kamp. 19 Kore wey Ebiasaf born, na-im pikin Shallum, with Korah pipol dey guide di door-mot for di tent where God present dey, just as dia grand-grand papa do before. 20 Finehas wey bi Eleazar pikin, na-im dey lead dem before and God dey with am. 21 Zekaraya wey bi Meshelemaya pikin, don still bi guide before for Tabanako.
22 All di men wey guide di gates na 212. Dem register dem akordin to where dem stay. Na King David and Samuel wey bi profet, put dem for dis pozishon. 23 Na dem with dia shidren-shidren still dey guide di temple gate. 24 Doz wey dey guide di gate dey for di four side wey face nort, sout, east and west. 25 Dia family dey kom help and join dem guide for seven days. 26 Di four main guide na from Levi tribe where dem for bi leaders. Na dem still dey kare for di store room and evritin wey dem keep for di temple. 27 Dem dey sleep near di temple, bikos na dia work to guide and open di gate evritime.
28 Some of dem dey keep di tins wey dem take dey woship God for di temple. Na dem dey bring and keep dem anytime wey dem use di tins finish. 29 Na dem dey keep di holy tins, flour, wine, olive oil, incense and spices. 30 But na di priests dey mix di spices. 31 Mattitaya wey kom from Levi tribe, wey bi Shallum first pikin for Korah family, na-im dey bake di bread wey dem dey use for ofrin. 32 Na Kohat family pipol dey bake di holy bread for di temple wen Sabat Day rish.
33 Some family for Levi; dia work na to dey play music for di temple. Doz wey dey head dis family dey stay di rooms for di temple and dat na only wetin dem dey do, bikos dem fit koll dem to play, both for day and nite.
34 Doz wey dem rite dia name down, dey head families for Levi tribe and dem dey stay for Jerusalem.
Jehiel Shidren-shidren
35 Jeiel (wey bi Gibeon papa) dey stay for Gibeon town.
En wife name na Maaka. 36 En first pikin na Abdon, before Zur, Kish, Baal, Ner, Nadab, 37 Gedor, Ahio, Zekaraya and Miklot 38 wey bi Shimea papa. Dem dey stay Jerusalem near dia oda family.
39 Na Ner bi Kish papa and na dis Kish born King Saul. Saul born four sons: Jonatan, Malki-Shua, Abinadab and Eshbaal.
40 Na Jonatan bi Merib-Baal papa and na Merib-Baal born Mikah.
41 Mikah four sons na:
Piton, Melek, Tarea and Ahaz.
42 Ahaz na Jehoaddah papa and Jehoaddah three sons na: Alemet, Azmavet and Zimri. Na Zimri bi Moza papa. 43 Moza born Binea; Binea born Rafaaya wey bi Eleasah papa and na Eleasah born Azel.
44 Azel born six sons:
Azrikam, Bokeru, Ishmael, Shearaya, Obadaya and Hanan. Na Azel pikin dem bi.