10
King Saul Die
Filistia pipol fight with Israel pipol for Gilboa mountin. Dem kill many Israel pipol for der and di ones wey remain, run komot from der. But Filistia pipol porshu dem katch kon kill Saul three shidren: Jonatan, Abinadab and Malki-Shua. Di fight strong well-well for where Saul dey, so di enemies spear kon tosh and wound King Saul.
Den Saul tell di boy wey karry en swod sey, “Make yu kill mi with yor swod, so dat all dis Filistia pipol wey nor know God nor go kom sofa mi.”
But fear nor let di boy do am. So Saul take en own swod take kill ensef. Wen di boy si sey Saul don die, en too kon kill ensef. So Saul with en three shidren die togeda and nobody for en family dey to rule again.
Wen Israel pipol wey dey Jezrel Valley hear sey di sojas don run and Saul with en shidren don die, dem kon run leave dia towns. Den Filistia pipol kon seize and start to stay di town.
Di next day wen Filistia pipol kom gada tins from di pipol wey dem kill, dem kon si sey Saul with en three shidren don die for Gilboa mountin. Dem kut Saul head komot, remove en war klot kon send message go evriwhere for Filistia sey, make dem tell dia pipol and juju about di good news. 10 Dem put en weapon for one of dia temple kon hang en head for dia juju wey dem dey koll Dagon, temple.
11 Wen Jabesh pipol for Ramot hear wetin Filistia pipol do to Saul, 12 doz wey get heart kon go take Saul and en shidren body go beri for Jabesh. Dem beri dem under one oak tree kon fast for seven days.
13 Saul die bikos e nor respet or obey God kommand. E go meet spirit make e help am 14 instead of God wey go guide am. So God kill-am kon make David wey bi Jesse pikin, king for Israel.