8
Benjamin Shidren-shidren
Benjamin first son na Bela,
sekond to Ashbel, before Ahara, Nohah and Rafa.
Bela shidren-shidren na:
Addar, Gera, Abihud,
Abishua, Naaman, Ahoah,
Gera, Shefufan and Huram.
Dis na Ehud shidren-shidren. Dem bi di head for dia family and na Gibeah dem dey stay, but dem force dem go stay for Manahat.
Ehud shidren na Naaman, Ahijah and Gera. Gera, wey bi Uzza and Ahihud papa, na-im lead dem for di journey.
Afta Shaharaim porshu en too wifes, Hushim and Baara, e still born shidren wen e dey Moab land. E marry Hodesh wey born seven sons for am and dia names na: Jobab, Zibia, Mesha, Malkam, 10 Jeuz, Sakia and Mirmah. All en shidren na leaders for dia family. 11 Hushim still born two sons for am: Abitub and Elpaal.
12 Elpaal born three sons:
Eber, Misham and Shemed. Na Shemed build Ono and Lod town with all di village wey dey near am.
Benjamin Pipol For Gat and Aijalon
13 Beraya and Shema na leaders for dia family and dem go stay for Aijalon kon porshu doz wey dey stay for Gat town komot.
14 Beraya shidren na: Ahio, Shashak, Jerimot, 15 Zebadaya, Arad, Eder, 16 Mikael, Ishpah and Joha.
Benjamin Pipol For Jerusalem
17 Elpaal shidren na: Zebadaya, Meshullam, Hizki, Heba, 18 Ishmerai, Izlaya and Jobab.
19 Shimei shidren na: Jakim, Zikri, Zabdi, 20 Elienai, Zilletai, Eliel, 21 Adaya, Beraaya and Shimrat.
22 Shashak shidren na: Ishpan, Eber, Eliel, 23 Abdon, Zikri, Hanan, 24 Hananaya, Elam, Antotijah, 25 Ifdeaya and Penuel.
26 Jeroham shidren na: Shamsheraya, Sheharaya, Atalaya 27 Jaareshaya, Elijah and Zikri.
28 All dis na di leaders for di family with dia shidren-shidren for Jerusalem just as dem rekord am.
Benjamin Pipol For Gibeon and Jerusalem
29 Na Jeiel build Gibeon town.
En wife na Maaka 30 and en first pikin name na Abdon, sekond to Zur, before Kish, Baal, Ner, Nadab, 31 Gedor, Ahio, Zeka 32 and Miklot wey bi Shimea papa. All dis family stay for Jerusalem near dia oda family pipol.
King Saul Family
33 Na Ner bi Kish papa and na Kish born King Saul. Saul born four sons: Jonatan, Malki-Shua, Abinadab and Eshbaal.
34 Na Jonatan bi Meribbaal papa and Merib-Baal born Mikah.
35 Mikah born four sons:
Piton, Melek, Tarea and Ahaz.
36 Ahaz na Jehoaddah papa and Jehoaddah born three sons: Alemet, Azmavet and Zimri. Na Zimri bi Moza papa. 37 Na Moza born Binea, Binea born Rafah wey bi Eleasah papa and na Eleasah born Azel.
38 Azel born six sons: Azrikam, Bokeru, Ishmael, Shearaya, Obadaya and Hanan.
39 Azel broda, Eshek born three sons:
Ulam, Jeush and Elifelet. 40 Ulam sons na strong sojas. En shidren with en grand-shidren, na 150 dem bi.
Na dis pipol bi Benjamin shidren-shidren.