7
Issakar Shidren-shidren
Issakar four sons na:
Tola, Puah, Jashub and Shimron.
Tola six sons na:
Uzzi, Refaaya, Jeriel, Jahmai, Ibsam and Shemuel. Dem bi popula sojas and na dem dey head each family. For di time wen David bi king, di wariors for di family na 22,600.
Uzzi born Izrahaya
Izrahaya kon born Mikael, Obadaya, Joel and Isshaya and all of dem dey head dia family. Dem get many wifes and shidren and dem still get 36,000 wariors.
All di wariors wey dem rekord for Issakar family na 87,000.
Benjamin And Dan Shidren-shidren
Benjamin born three sons:
Bela, Beka and Jediael.
Bela kon born five sons: Ezbon, Uzzi, Uzziel, Jerimot and Iri.
Beka born nine sons: Zemirah, Joash, Elieza, Elioenai, Omri, Jerimot, Abijah, Anatot and Alemet. All of dem na leader for di family. Na 20,200 wariors dem rekord for di family.
10 Jediael born one pikin wey dem dey koll Bilhan.
Bilhan born seven sons:
Jeush, Benjamin, Ehud, Kenaana, Zetan, Tarshish and Ahishahar. 11 Dem dey head dia family. Na 17,200 wariors dey ready for war for dis family.
12 Ir sons na Shuppim and Huppim. Na Aher born Hushim.
Naftali Shidren-shidren
13 Naftali born four sons:
Jahziel, Guni, Jeza and Shallum. Dem bi Bilhah shidren.
Manasseh Shidren-shidren
14 Manasseh girl-friend for Aramean born two sons for am and dem bi:
Asriel and Makir. Na Makir born Gilead. 15 Makir marry wife for Huppim and Shuppim. (En sista name na Maaka.)
Zelofehad na Manasseh sekond son and na only girl shidren e born.
16 Maaka wey bi Makir wife, born two boys: Peresh and Sheresh. Peresh sons na: Ulam and Rekem.
17 Ulam pikin na Bedan.
Ramot wey Makir born, na en shidren-shidren bi dis and na Manasseh bi Gilead grand-grand papa. 18 Ramot sista, Hammoleket born three sons: Ishhod, Abiezer and Mahlah.
19 Shemida sons na:
Ahian, Shekem, Likhi and Aniam.
Efraim Shidren-shidren
20 Efraim shidren-shidren na: Shutela, Bered, Tahat, Eleada, Tahat and
21 Zabad Shutela.
(Afta Shutela, Efraim still born Ezer and Elead wey dem kill wen dem go tif animal for Gat pipol land.) 22 Efraim wey bi dia papa kry for dem well-well and en brodas kon dey sorry for am. 23 E sleep with en wife again and e kon born and dem koll di pikin Beraya, bikos di family don face trobol well-well. 24 Efraim born one girl and en name na Sheerah. Na en build Uppa and Lowa Bet-Horon and Uzzen Sheerah towns.
25 Efraim still born one son, Refah.
Refah shidren-shidren na: Reshef, Telah, Tahan,
26 Ladan, Ammihud, Elishama,
27 Nun and Joshua.
28 Dia propaty and lands na Bethel and di towns wey dey near am, go rish Naaran for di east and Geza for di west. Dem still stay for Shekem and Ayyah and all di towns wey near dem. 29 Na Manasseh shidren-shidren dey kontrol Bet-Shean, Taanak, Megiddo, Dor and di oda towns wey dey near dem. Josef wey bi Jakob pikin, na en shidren-shidren stay all dis towns.
Asher Shidren-shidren
30 Na Asher shidren-shidren bi dis: e born four sons:
Imnah, Ishvah, Ishvi and Beraya with one dota wey en name na Serah.
31 Beraya born two sons:
Heba and Malkiel. Na Malkiel bi Birzait papa.
32 Heba born three sons:
Jaflet, Shoma and Hotam with one dota, Shua. 33 Jaflet still born three sons: Pasak, Bimhal and Ashvat.
34 En broda Shema sons na: Ahi, Rohgah, Hubbah and Aram:
Rohgah, Hubbah and Aram. 35 While dia last broda, Helem born four sons: Zofah, Imna, Shelesh and Amal.
36 Zofah shidren-shidren na:
Suah, Harnefa, Shual, Beri, Imrah,
37 Beza, Hod, Shamma, Shilshah, Itran and Bera.
38 Jeta shidren-shidren na:
Jefunneh, Pispa and Ara.
39 While Ulla shidren-shidren na:
Arah, Hanniel and Rizia.
40 All dis pipol na Asher shidren-shidren. Dem dey head dia family and dem bi popula sojas. Asher wariors na 26,000 just as dem rekord am.