6
Di High Priest Family
Levi three shidren na:
Gershon, Kohat and Merari.
Kohat born four shidren:
Amram, Izhar, Hebron and Uzziel.
Amram two sons na:
Aaron and Moses and en girl pikin name na Miriam.
Aaron get four sons wey bi:
Nadab, Abihu, Eleazar and Itama.
Eleazar bi Finehas papa,
Finehas bi Abishua papa,
Abishua bi Bukki papa, Bukki bi Uzzi papa,
Uzzi bi Zerahaya papa, Uzzi bi Meraiot papa,
Meraiot bi papa, Amaraya bi Ahitub papa, Ahitub bi Zadok papa,
Zadok bi Ahimaaz papa, Ahimaaz bi Zabud papa,
Zabud kon born Johanan,
10 (Na dis Zabud bi di priest for di temple wey King Solomon build for Jerusalem),
11 Zabud bi Amaraya papa, Amaraya bi Ahitub papa,
12 Ahitub bi Zadok papa, Zadok bi Shallum papa,
13 Shallum bi Hilkaya papa, Hilkaya bi Zabud papa,
14 Zabud bi Seraya papa, Seraya bi Jehozadak papa.
15 King Nebukadnezzar kon karry Jehozadak with Judah and Jerusalem pipol go Babilon as slave.
Levi Shidren
16 Levi born three sons:
Gershom, Kohat and Merari.
17 All of dem still born sons too. Na Gershom born
Libni and Shimei:
18 Kohat kon born
Amram, Izhar, Hebron and Uzziel;
19 Merari na Mahli and Mushi papa.
20 Gershom shidren-shidren na:
Libni, Jahat, Zimma,
21 Joah, Iddo, Zera and Jeaterai.
22 Kohat shidren-shidren na:
Amminadab, Korah, Assir,
23 Elkanah, Ebiasaf, Assir,
24 Tahat, Uriel, Uzzaya and Shaul.
25 Elkanah shidren-shidren na
Amasai, Ahimot,
26 Elkanah, Zofai, Nahat,
27 Eliab, Jeroham, Elkanah and Samuel.
28 Samuel sons na:
Joel (na-im bi senior),
sekond to Abijah.
29 Merari shidren-shidren na:
Mahli, Libni, Shimei, Uzza,
30 Shimea, Haggiaya and Asaya.
Music For Di Temple
31 Na di men wey David put for di temple make dem dey play music afta dem don karry di Kovenant Box go der, bi dis. 32 Na dem dey do all di work for Tabanako, before King Solomon build temple for Jerusalem.
33 Doz wey serve along with di sons na:
From Kohat pipol:
Heman wey Samuel pikin Joel born and naim dey lead di first kwaya.
34 Samuel na Elkanah pikin.
Jeroham wey Eliel born,
na-im bi Elkanah papa.
Eliel na Toah pikin.
35 Na Zuf born Toah
and na Elkanah bi Zuf papa.
Elkanah na Mahat pikin
and na Amasai born Mahat.
36 Amasai na Elkanah pikin.
Elkanah na Joel pikin
and na Zabud born Joel.
Zabud na Zefanaya pikin.
37 Tahat wey Assir born,
na-im bi Zefanaya papa.
38 Assir na Ebiasaf pikin
and na Korah born Ebiasaf.
Korah na Izhar pikin.
Na Kohat born Izhar.
Levi wey Israel born,
na-im bi Kohat papa.
39 Na Asaf dey lead di sekond kwaya
and na Berekaya bi en papa.
Berekaya na Shimea pikin.
40 Mikael wey Baaseaya born,
na-im bi Shimea papa.
Baaseaya na Malkijah pikin
41 and na Etni born Malkijah.
Etni na Zera pikin and na Adaya wey
42 Etan born bi Zera papa.
Etan na Zimma pikin
and na Shimei born Zimma.
43 Shimei na Jahat pikin.
Na Gershom born Jahat. Gershom na Levi pikin.
44 Levi pipol wey serve near dem na Etan wey kom from Merari family.
Etan na Kishi pikin and Kishi na Abdi pikin.
Abdi na Malluk pikin,
45 and na Hashabaya bi Malluk papa.
Hashabaya na Amazaya pikin
and na Hilkaya bi Amazaya papa.
46 Amzi wey Bani born,
na-im bi Hilkaya papa. Bani na Shema pikin,
47 while Shema na Mahli pikin.
Na Mushi born Mahli
and na Merari bi Mushi papa.
Merari na Levi pikin.
48 Di remainin pipol for Levi wey dem give work for God house, na dem bi dis. 49 Na Aaron and en shidren-shidren dey offa sakrifice for God altar. Na dem dey kare for di holy place and for all di sakrifice wey go make God forgive Israel pipol dia sins. Dem do all dis tins, just as Moses kommand dem.
50 Aaron shidren-shidren na:
Eleazar wey born Finehas
and na Finehas bi Abishua papa.
51 Abishua na Bukki papa.
Na dis Bukki born Uzzi wey bi Zerahaya papa.
52 Na Zerahaya born Meraiot wey bi Amaraya papa
and Amaraya born Ahitub.
53 Na Ahitub bi Zadok and Ahimaaz papa.
Levi Pipol
54 Aaron wey kom from Kohat family with en shidren-shidren, na where e dey stay bi dis. Di first share wey dem give Levi pipol for di land, na dem take am.
55 Na dem get Hebron near Judah and all di land wey dey near am. 56 Di lands and village wey dey di town, dem gi-am to Kaleb wey bi Jefunneh pikin.
57 Dis na di towns wey dem give Aaron shidren-shidren: Hebron, Libnah, Jattir, Eshtemoa, 58 Hilez, Debir, 59 Ashan and Bet-Shemesh with all dia land. 60 Di towns and lands wey dem give dem for Benjamin aria na: Gibeah, Alemet and Anatot.
So all di towns na thirteen.
61 Dem give di rest pipol for Kohat shidren-shidren ten towns, wey bi half of Manasseh tribe.
62 Dem give Gershom shidren-shidren, thirteen towns for Issakar, Asher, Naftali and East Manasseh wey dey for Bashan aria.
63 Na so too, dem still give all Merari family twelf towns for Reuben, Gad, and Zebulun aria.
64 Na like dis too, Israel pipol take give Levi pipol dia towns and lands. 65 Di towns for Judah, Simeon and Benjamin aria wey dem rite down before, dem still give dem to Levi pipol.
66 Some among di family, dem give dem Kohat towns and dia lands wey dey Efraim aria.
67 Dem still give dem Shekem towns and some lands wey dey for Efraim hill kountry with Geza and dia lands too. 68 Dem still give Levi pipol Jokmeam, Bet-Horon, 69 Aijalon and Gat-Rimmon towns with all dia lands.
70 For West Manasseh aria, dem give dem Aner and Bileam towns with all dia land.
71 Dis na di land and field wey dem give Gershom tribe:
For East Manasseh aria, dem give dem:
Golan for Bashan and Ashtarot.
72 For Issakar aria, dem give dem:
Kedesh, Daberat, 73 Ramot and Anem.
74 For Asher aria, dem give dem:
Mashal, Abdon, 75 Hukok and Rehob.
76 For Naftali aria, dem give dem:
Kedesh for Galilee, Hammon and Kiriataim.
77 Di remainin family wey dey Merari tribe, na di land wey dem give dem bi dis:
For Zebulun aria, dem give dem:
Rimmono and Tabor.
78 For Reuben aria wey dey di east side for Jordan River afta Jeriko, dem give dem:
Beza, Jahza, 79 Kedemot and Mefaat.
80 For Gad aria, dem give dem:
Ramot for Gilead, Mahanaim, 81 Heshbon and Jazer.