5
Reuben Shidren-shidren
Reuben wey bi Jakob first pikin, na en shidren-shidren bi dis. But bikos e sleep with en papa wife, di papa kon give en senior pozishon to Josef. So for dia family history, dem nor rite Reuben as di first-born. Bikos na Judah strong pass, dem kon make am leader among en brodas, but na Josef dem still take as first pikin. Reuben wey bi Jakob first pikin, en four sons na:
Hanok, Pallu, Hezron and Karmi.
Joel shidren-shidren na:
Shemaya, Gog, Shimei,
Mikah, Reaaya, Baal and
Beerah wey bi leader for Reuben tribe wey Tilgat-Pilneser, Assyria king karry go anoda land.
Dis na di names wey dem rite for di family:
Jeiel, Zekaraya and Bela wey Azaz born and na Shema wey kom from Joel tribe, bi en grand-papa. Dis tribe dey stay for Aroer go rish Nebo and Baal-Meon. Bikos dem get many animals for Gilead land, dem kon spread face east for di wildaness side go rish Eufrates River.
10 For di time wen Saul bi king, Reuben tribe attack and kill Hagrit pipol for war, den dem take dia land for di east side for Gilead.
Gad Shidren-shidren
11 Gad tribe stay from Bashan land near Reuben tribe land go rish Salekah wey dey di east.
12 Na Joel dey lead dem, sekond to Shafam, before Janai and Shafat.
13 Di oda seven membas akordin to dia family na:
Mikael, Meshullam, Sheba, Jorai, Jakan, Zia and Eber.
14 And dia grand-grand papa dem na: Abihail wey Huri born, wey Jaroah born, wey Gilead born, wey Mikael born, wey Jeshishai born, wey Jahdo wey bi Buz pikin, born. 15 Na Guni pikin, Abdeil born Ahi wey bi leader for dis family.
16 Dem dey stay for Bashan and Gilead aria and all di good land wey dey Sharon.
17 (Dem rite all dis tins wen King Jotam dey rule for Judah and King Jeroboam dey rule for Israel.)
Di Sojas For East
18 Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe get 44,760 sojas and dem don train dis men well-well on how to dey guide, use swod and shot arrow. 19 Dem go fight Hagrit, Jetur, Nafish and Nodab pipol. 20 Dem ask and pray to God make E help dem and God ansa dia prayers kon make dem win di war. 21 Dem katch 50,000 kamel; 250,000 sheep; 2,000 donkey and 100,000 men as prisonas from dia enemies. 22 Dem kill many enemies, bikos God fight for dem. So dem kon dey stay dat aria until dem karry dem go Babilon as slaves.
Half of Manasseh Tribe
23 Di pipol wey dey half of Manasseh tribe kon stay from Bashan go rish Baal-Hermon, Senir and Mount Hermon and dem kon dey many well-well.
24 Di leaders for dia family na: Efer, Ishi, Eliel, Azriel, Jeremaya, Hodevah and Jahdiel. All of dem na strong sojas wey pipol know well-well for di land. 25 Di God wey dia grand-grand papa woship, dem nor gri obey en kommand, instead di nashons wey God porshu komot di land, Israel pipol kon dey woship dia juju. 26 So God make King Pul for Assyria (wey dem still dey koll Tilgat-Pilneser) attack dia kountry. E karry Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe go stay for Halah, Habor, Hara and Gozan River and na der dem dey till today.