4
Judah Shidren-shidren
Judah shidren-shidren na:
Perez, Hezron, Karmi, Hur and Shobal.
Na Shobal bi Reaaya papa; Reaaya na Jahat papa; Jahat kon bi Ahumai and Lahad papa and na dem bi Zorah pipol grand-grand papa.
Etam sons na:
Jezrel, Ishma and Idbash. Dia sista name na Hazelelponi. Na Penuel bi Gedor papa, while Ezer kon bi Hushah papa.
Hur wey bi Efrat first pikin and Betlehem pipol papa, na en shidren-shidren bi dis.
Ashhur wey bi Tekoa papa marry two wifes; Helah and Naarah.
Naarah born Ahuzzam, Hefa, Temeni and Haahashtari.
Helah sef born: Zeret, Zohar, Etnan and Koz wey kon bi papa to Anub, Hazzobebah and Aharhel pipol wey Harum born.
E get one man wey dem dey respet well-well among en brodas and en name na Jabez. En mama koll am Jabez (wey mean pain) bikos e sey, “I sofa well-well wen I won born yu.” 10 Jabez kon pray, “Israel God, make Yu bless mi and let my land big well-well. Make yor hand dey with mi kon save mi from trobol, so dat sofa nor go kill mi!” So God kon ansa en prayer.
11 Kelub wey bi Shuha broda, na-im bi Mehir papa and na Mehir born Eshton. 12 Na Eshton born Bet-Rafa, Paseah and Tehinnah wey bi Ir Nahash papa. All of dem na Rekah men.
13 Kenaz born Otniel and Seraya;
Otniel born Hatat and Meonotai.
14 Na Meonotai bi Ofrah papa and na Seraya born Joab.
Na dis Joab born doz pipol wey dey stay and karve wood for Ge-Harashim.
15 Kaleb wey Jefunneh born, en sons na:
Iru, Elah and Naam. Na Elah bi Kenaz papa.
16 Jehallelel sons na:
Zif, Zifah, Tiria and Asarel.
17 Ezra sons na:
Jeta, Mered, Efer and Jalon. Na Eshtemoa wey bi Mered wife born Miriam, Shammai and Ishbah wey bi Eshtemoa papa. 18 Mered still marry one woman wey kom from Judah tribe and dem born three sons: Jared wey build Gedor town: Heba wey build Soko town and Jekutiel wey build Zanoah town.
19 Hodaya marry Naham sista. Na one among di woman son bi papa to Keilah wey kom from Garm and Eshtemoa wey kom from Maakat.
20 Shimon four shidren na: Amnon, Rinnah, Ben-Hanan and Tilon. Ishi shidren-shidren na: Zohet and Ben Zohet.
Shelah Shidren-shidren
21 Shelah na one among Judah sons and na-im born
Er wey Leka papa; Laada wey bi Maresha papa from Bet-Ashbea town where dem for dey make linen; 22 Jokim and all di pipol wey dey stay for Kozeba town. E still born Joash and Saraf wey rule for Moab and Jashubi Lehem. (All dis names na from di old rekord book). 23 Na dem bi di potta wey stay for Netaim and Gederah dey work for di king.
Simeon Shidren-shidren
24 Simeon shidren-shidren na:
Nemuel, Jamin, Jarib, Zera and Shaul.
25 Shaul sons na: Shallum, Mibsam and Mishma.
26 Mishma sons na: Hammuel, Zakkur and Shimei.
27 Shimei get sixteen sons and six dotas. But en brodas nor born many shidren, so dia family nor many rish Judah sons. 28 Simeon shidren-shidren stay for Beersheba, Moladah, Hazar-Shual, 29 Bilhah, Ezem, Tolad, 30 Betuel, Hormah, Ziklag, 31 Bet-Marcabot, Hazar-Susim, Bet-Biri and Shaaraim. Dis na dia towns till David kon bi king. 32 Dem still stay for Etam, Ain, Rimmon, Token and five towns for Ashan. 33 Dem still stay for all di small-small village wey dey near dis towns go rish Baal. Na where dem stay bi dat and dem rite and keep all dia family history.
34 Dia family leaders na: Meshobab, Jamlek, Joshah wey bi Amazaya pikin, 35 Joel, Jehu wey bi Joshibaya pikin and na Seraya wey Asiel born bi en grand-papa. 36 E still get Elioenai, Jaakobah, Jeshohaya, Asaya, Adiel, Jesimiel, Benaya, 37 Ziza wey bi Shipi pikin. Na Allon wey Jedaya born, bi Shipi papa. Shimri born Jedaya and na Shemaya bi Shimri papa.
38 Na dis pipol bi di leaders for dia family. Dia family kon dey many more-more. 39 Dem go where dem dey take enter Gedor kon even waka rish di east side for di valley, dey find grass make dia animals chop. 40 Dem si betta big land, where nobody go for disturb dem, den dem kon give dia sheep grass chop. Some pipol from Ham don dey stay der before dat time.
41 Di men wey dem rite dia names before, kom for di time wey Hezekaya bi king for Judah and dem attack and kill Ham and all Meun pipol wey dem si for der, bikos dem si grass wey dia animals go chop. 42 Pelataya, Nearaya, Refaaya and Uzziel wey bi Ishi pikin, na dem lead Simeon five hundred men go di hill kountry for Seir, 43 where dem for kill Amalek pipol wey run go stay der and dem dey stay der kon rish today.