3
David Shidren-shidren
Dis na shidren wey dem born for David wen e dey Hebron:
Di first pikin na Amnon, en mama na Ahinoam wey kom from Jezrel:
di sekond one na Daniel, en mama name na Abigail, wey kom from Karmel.
Di third one na Absalom, en mama name na Maaka and na Talmai wey bi Geshur king, born am;
di next one na Adonijah and na Haggit bi en mama;
Shefataya na di fift one and en mama name na Abital;
Itream wey en mama name na Eglah, na-im bi di sixt one.
Dis na di six shidren wey dem born give David for Hebron where e for rule for seven years and six monts.
E rule Jerusalem for thirty-three years:
Shimea, Shobab, Natan and Solomon na di sons wey dem born give David for Jerusalem and na Batsheba wey bi Ammiel pikin, bi dia mama. David oda nine shidren na: Ibhar, Elishua, Elifelet, Nogah, Nefeg, Jafia, Elishama, Eliada and Elifelet. Na David sons bi dis, dem nor kount di sons wey en girl-friends born for am. Tamar na dia sista.
Solomon Shidren-shidren
10 Solomon born Rehoboam,
Rehoboam born Abijah,
Abijah born Asa
wey born Jehoshafat,
11 Jehoshafat born Joram,
Joram born Ahazaya
and Ahazaya born Joash.
12 Joash born Amazaya
wey born Zabud;
Zabud born Jotam
and Jotam kon born Ahaz.
13 Ahaz born Hezekaya;
na Hezekaya born Manasseh
and na Manasseh bi Amnon papa.
14 Amon na Josaya papa.
15 Josaya sons na:
Johanan, Jehoiakim, Zedekaya and Shallum.
16 Jehoiakim sons na:
Jehoiashin and Zedekaya.
17 Jehoiashin sons wey Babilon pipol karry go prison na:
Shealtiel, 18 Malkiram, Pedaaya, Shenazzar, Jekamaya, Hoshama and Nedabaya.
19 Pedaaya shidren-shidren na:
Zerubabel and Shimei.
Na Meshullam and Hananaya bi Zerubabel shidren and na Shelomit bi dia sista.
20 Zerubabel oda five shidren na:
Hashubah, Ohel, Berakaya, Hasadaya and Jushab-Hesed.
21 Hananaya shidren-shidren na:
Pelataya and Jeshaya. Jeshaya born Refaaya wey bi Arnan papa and na Arnan born Obadaya wey bi Shekanaya papa.
22 Shekanaya born only
Shemaya and Shemaya sons na:
Hattush, Igal, Baraya, Nearaya and Shafat. All of dem na six.
23 Nearaya three sons na:
Elioenai, Hezekaya and Azrikam.
24 Elioenai get seven sons and dem bi:
Hodevah, Eliashib, Pelaaya, Akkub, Johanan, Delaaya and Anani.