2
Israel Shidren-shidren
Israel sons na:
Reuben, Simeon, Levi, Judah, Issakar, Zebulun, Dan, Josef, Benjamin, Naftali Gad and Asher.
Judah Shidren-shidren
Judah sons na:
Er, Onan and Shelah. Na one Kanaan woman wey en name na Batshua, born dis three shidren for Judah. Er wey bi Judah first pikin kon make God vex and God kill-am. Tamar wey bi Judah pikin wife, born Perez and Zera give Judah and all en sons kon bi five.
Perez sons na:
Hezron and Hamul.
Zera sons na:
Zimri, Etan, Heman, Kalkol and Dara.
Karmi sons na:
Akan wey bring wahala kom Israel wen e tif wetin dem dedikate give God.
Na Etan born Zabud.
Di sons wey dem born give Hezron na:
Jerahmeel, Ram and Kaleb.
Ram shidren-shidren
10 Na Ram bi
Amminadab papa and Amminadab born Nahshon wey bi shief for Judah tribe. 11 Nahshon born Salma and na Salma born Boaz. 12 Boaz na Oded papa and na Obed born Jesse.
13 Eliab na Jesse first pikin, why Abinadab na di sekond born, follow by Shimea, 14 before Netanel, Raddai, 15 Ozem and David. 16 Dia sistas na Zeruaya and Abigail. Zeruaya three sons na: Abishai, Joab and Asahel. 17 Abigail born Amasa wey en papa kom from Ishmael tribe.
Kaleb Shidren-shidren
18 Kaleb wey bi Hezron pikin marry Azuba wey dem still dey koll Jeriot. En sons na: Jesher, Shobab and Ardon. 19 Wen Azuba die, Kaleb kon marry Efrat and e born Hur for am. 20 Na Hur bi Uri papa and na Uri born Bezalel.
21 Wen Hezron don rish sixty years, e kon marry Gilead sista wey Makir bi dia papa and e born Segub for am. 22 Na Segub bi Jair papa, wey get twenty three towns for Ramot land. 23 But Geshur and Aram win Jair, Kenat and sixty towns for der. All dis shidren na Makir wey bi Gilead papa grand-grand shidren.
24 Afta Hezron don die, Kaleb kon sleep with Efrat wey bi en papa wife and e born Ashhur wey bi Tekoa papa.
Jerahmeel Shidren-shidren
25 Jerahmeel wey bi Hezron first son, en shidren na:
Ram, Bunah, Oren, Ozem and Ahijah.
26 Jerahmeel get anoda wife wey dem dey koll Atarah and na en bi Onam mama.
27 Ram wey bi Jerahmeel first son, en shidren na:
Maaz, Jamin and Eker.
28 Onam sons na:
Shammai and Jada. Shammai sons na Nadab and Abishur.
29 Na Abihail bi Abishur wife and e born Ahban and Molid for am.
30 Nadab sons na:
Seled and Appaim. Seled nor born boy pikin before e die.
31 Appaim son na:
Ishi and Ishi born Sheshan, while Sheshan born Ahlai.
32 Jeda wey bi Shammai broda, en sons na:
Jeta and Jonatan. Jeter nor born boy pikin before e die.
33 Jonatan sons na:
Pelet and Zaza. Na Jerahmeel shidren-shidren dem bi.
34 Sheshan born only girls.
Sheshan get one Egypt pesin wey bi en savant and en name na Jarha. 35 Sheshan give en girl pikin to en savant as wife and e kon born Attai for am.
36 Na Attai bi Natan papa, while Natan kon bi Zabad papa.
37 Na Zabad bi Eflal papa, while Eflal born Obed.
38 Obed na Jehu papa and Jehu na Zabud papa.
39 Na Zabud bi Helez papa and Helez na Eleasah papa.
40 Eleasah born Sismai and na Sismai bi Shallum papa.
41 Jekamaya wey born Elishama, na Shallum bi en papa.
Oda Kaleb Shidren-shidren
42 Kaleb wey bi Jerahmeel broda, en sons na:
Mesha wey bi Zif papa and en sekond pikin na Maresha wey bi Hebron papa.
43 Hebron sons na:
Korah, Tappuah, Rekem and Shema. 44 Shema na Raham and Jorkeam papa. Rekem na Shammai papa. 45 Shammai son na Maon wey bi Bet-Zur.
46 Kaleb girl-friend wey dem dey koll Efah kon born Haran, Moza and Gazez. Na Haran bi Gazez papa.
47 Jahdai sons na:
Regem, Jotam, Geshan, Pelet, Efah and Shaaf.
48 Kaleb girl-friend wey bi Maaka born Sheba and Tirhana. 49 Na Maaka still born Shaaf wey bi Madmanna, Sheva, Makbena and Gibea papa. Kaleb girl pikin na, Aksah. 50 All dis na Kaleb shidren-shidren.
Hur wey bi Efrat first pikin, na en sons bi dis:
Shobal wey bi Kiriat-Jearim papa; 51 Salma wey bi Betlehem papa, naim still born Haref wey bi Bet-Gada papa.
52 Shobal wey bi Kiriat-Jearim papa, en sons na:
Haroeh and half of Manahat pipol. 53 Kiriat-Jearim family na: Itrite, Put, Shumat and Mishra pipol. Pipol for Zorat and Eshtaol kom from dis group.
54 Salma sons na:
Betlehem, Netofat, Atrot Bet-Joab, half of Manahat and Zor pipol, 55 while di skribe pipol wey dey stay for Jabez na: Tirat, Shimeat and Sukat. Dis na Ken pipol wey kom from Hamat, wey bi Rekab papa.