First Kronikles
1
Adam Shidren-shidren
Na Adam born Seth, Seth born Enosh, Enosh born Kenan and na Kenan born Mahalalel. Na Mahalalel bi Jared papa. Jared born Enoch, Enoch born Metuselah, Metuselah kon born Lamek.
Lamek born Noah,
Noah born Shem, Shem born Ham and na Ham born Jafet.
Jaflet Shidren-shidren
Jafet shidren na:
Gomer, Magog, Madai, Javan, Tubal, Meshak and Tiras.
Gomer shidren na:
Ashkenaz, Difat and Togarmah.
Javan shidren na:
Elisha, Tarshish, Kittite and Rodan.
Ham Shidren-shidren
Ham shidren na:
Kush, Mizraim, Put and Kanaan.
Kush shidren na:
Seba, Havilah, Sabteka, Rama and Sabtah.
Rama shidren na:
Sheba and Dedan.
10 Na Kush born Nimrod
and Nimrod kon bi di first pesin wey strong well-well for di world.
11 Na Mizraim born
Lud, Anam, Lehab, Naftuh, 12 Patrus, Kasluh, Krete (wey Filistia pipol from kom) and Kaftor pipol too.
13 Na Kanaan bi
Sidon and Het papa, but na Sidon bi en first pikin.
14 Na Kanaan still born Jebus, Amor, Girgash, 15 Hiv, Ark, Sin, 16 Arvad, Zemar and Hamat pipol.
Shem Shidren-shidren
17 Shem shidren na:
Elam, Asshur, Arfaxad, Lud and Aram.
Aram shidren-shidren na:
Uz, Hul, Geta and Meshak.
18 Na Arfaxad born Shelah
and na Shelah bi Eber papa.
19 Eber born two pikin:
one name na Peleg (wey mean divide), bikos e born am for di time wen God take divide and make pipol dey speak difren language for di world. Di oda pikin name na Joktan.
20 Joktan shidren na
Almodad, Shelef, Hazar-Mavet, Jerah, 21 Hadoram, Uzal, Diklah, 22 Ebal, Abimael, Sheba, 23 Ofir, Havilah and Jobab pipol.
24 Na Shem and Abram family pipol bi dis:
Shem, Arfaxad, Shelah,
25 Eber, Peleg, Reu,
26 Serug, Nahor, Terah
27 and Abram wey God shange en name to Abraham.
Abraham Family
28 Abraham born two sons:
Isaak and Ishmael.
29 Dis na dia shidren-shidren:
Na Nebaiot bi Ishmael first pikin, before e kon born Kedar, Adbeel, Mibsam, 30 Mishma, Dumah, Massa, Hadad, Tema, 31 Jetur, Nafish and Kedemah. Na Ishmael shidren dem bi.
Keturah shidren-shidren
32 Keturah wey bi Abraham girl-friend, na-im born Zimran, Jokshan, Medan, Midian, Ishbak and Shuah.
Na Jokshan born Sheba and Dedan.
33 Midian shidren na
Efah, Efer, Hanok, Abidan and Eldaah.
All dis pipol na Keturah sons.
Isaak Shidren-shidren
34 Na Abraham bi Isaak papa.
Isaak shidren na:
Esau and Jakob (wey God shange en name to Israel).
Esau Shidren-shidren
35 Esau shidren na:
Elifaz, Reuel, Jeush, Jalam and Korah.
36 Elifaz shidren na:
Teman, Omar, Zefi, Gatam, Kenaz,
but Timna still born Amalek for am.
37 Reuel shidren na:
Nahat, Zera, Shammah and Mizzah.
Seir Shidren-shidren
38 Seir shidren na:
Lotan, Shobal, Zibeon, Anah, Dishon, Ezer and Dishan.
39 Lotan shidren na:
Hori and Homam (and Timna, na Lotan sista).
40 Shobal shidren na:
Alvan, Manahat, Ebal, Shefi and Onam.
Zibeon shidren na:
Aiaya and Anah.
41 Anah son na
Dishon.
Na Dishon born
Hamran, Eshban, Itran and Keran.
42 Ezer shidren na:
Bilhan, Zaavan, Jaakan.
Na Dishan born
Uz and Aran.
Edom Kings
43 Na di kings wey rule Edom land before any king rule Israel pipol bi dis.
Bela wey Beor born and e kom from Dinhabah.
44 Wen Bela die, Jobab wey bi Zera pikin wey kom from Bozrah kon take-ova as king.
45 Wen Jobad die, Husham wey kom from Teman land kon take-ova as king.
46 Wen Husham die, Hadad wey Bedad born kon take-ova as king and e rule from Avit town. E win Midian pipol for war for Moab.
47 Wen Hadad die, Samlah wey kom from Masrekah kon take-ova as king.
48 Wen Samlah die, Shaul wey kom from Rehobot near di river kon take-ova as king.
49 Wen Shaul die, Baal-Hanan wey Akbor born kon take-ova as king.
50 Wen Baal-Hanan die, Hadad wey kom from Pau kon take-ova as king. En wife name na Mehetabel, wey bi Matred pikin and na Me-Zahab bi Matred mama. 51 Hadad kon die.
Di shief for Edom tribe na:
Timna, Alvah, Jetet, 52 Oholibama, Elah, Pinon, 53 Kenaz, Teman and Mibzar, 54 Magdiel and Iram. All dis na dis na Edom shiefs.