82
Na God Dey Judge 
 
Asaf Song 
 
1 God stand for where en pipol gada put  
and E from der dey judge di oda gods   
2 sey, “Na how long una go dey judge like dis  
kon dey favor wiked pipol?   
3 Poor pipol and doz wey nor get papa, make una judge dia kase well!  
Make una free poor pipol and doz wey dem dey opress.   
4 Poor pipol and doz wey nor get help,  
make una save dem from wiked pipol!   
5 But doz wey dey opress oda pipol,  
nor know anytin at-all.  
Dem bi fools! Dem dey waka anyhow for darkness,  
while all di foundashon for di eart dey skata.   
6 I bin sey, ‘Una bi gods;  
bikos una bi di Most High God shidren.’   
7 But naw, una go die like ordinary human being  
kon fall like evry oda leader.”   
8 So my God, make Yu raiz-up kon judge di world,  
bikos na Yu get all di nashons.