81
Feast Song 
 
Asaf Song For Di Kwayamasta 
 
1 Make wi sing praiz God wey bi awa strent.  
Make wi sing praiz Jakob God.   
2 Make una sing and play sheke-sheke.  
Make una use jita and harp play sweet music.   
3 Make una blow ram horn  
wons new moon or full moon festival start!   
4 Bikos dis na wetin dem rite for Israel law  
and na wetin Jakob God kommand.   
5 E make dis law for Israel pipol wen E attack Egypt land just to free us.  
Den I hear one vois wey I nor know dey sey,   
6 “Si, I don take di load komot from una shoulder;  
I don free una from di heavy work wey una dey do.   
7 Una kry to mi for help wen una dey trobol and I save una;  
I ansa with strong tonda  
kon test una faith wen wota nor dey to drink for Meribah.   
8 My pipol make una listin to mi as I dey warn una!  
Israel pipol, make una obey mi!   
9 Una must nor serve anoda god;  
una must nor bow before any oda god.   
10 Bikos na mi wey bi una Oga God, save una from Egypt land.  
Make una open una mout wide and I go pak good tins full am.   
11 But my pipol nor gri listin.  
Israel pipol nor wont make I dey with dem.   
12 So I let dem do di tins wey dey hongry dem to do  
kon live dia life di way dem wont am.   
13 How I wish my pipol go gri listin to mi!  
How I wish sey Israel pipol go follow mi kon do as I tell dem!   
14 Den I for fit kwik distroy dia enemies!  
My hand for kwik tosh doz wey dey worry dem!   
15 Make pipol wey hate God, fear as dem si am;  
make disgrace follow dem forever.   
16 But I go give Israel pipol betta food chop;  
I go make una beleful with betta honey  
wey dey flow kom out from di rock.”