83
Prayer To Win Israel Enemies 
 
Asaf Song 
 
1 My God, make Yu nor kwayet just like dat!  
Make Yu nor rijet us!  
Nor just do like sey e nor koncern Yu!   
2 Yu nor si di nois wey yor enemies dey make?  
Yu nor dey si sey yor sturbon enemies dey make mout anyhow?   
3 Dem dey plan against yor pipol  
and dem won wound di ones wey Yu love.   
4 Dem dey sey, “Make una kom make wi kill evribody for Israel finish  
and nobody go remember dem again.”   
5 All of dem gada togeda  
and dem dey plan against Yu.   
6 Dem wey gada so na:  
Edom and Ishmael pipol,  
Moab and Hagrit pipol;   
7 Gebal, Ammon and Amalek pipol  
with doz from Filistia and Tyre.   
8 Assyria pipol don join dem  
too with Lot shidren-shidren.   
9 So, make Yu do dem wetin Yu do Midian pipol and just as Yu do Sisera and Jabin for Kishon River,  
na so too Yu go do dem.   
10 Dem die for Endor and dia body  
kon make di grass grow well.   
11 Make di mighty ones among dem die like Oreb and Zeeb.  
Make all di prince die like Zebah and Zalmunna   
12 wey bin sey,  
“Make wi take dis land  
wey bi God own!”   
13 My God, make Yu skata dem like leaf  
and san-san wey breeze dey blow!   
14 As fire dey burn forest  
and smoke dey make mountin burn,   
15 na so too Yu go take porshu dem  
with yor strong tonda  
kon make dem fear.   
16 My God, make Yu disgrace dem finish  
until dem bigin praiz yor name.   
17 Make shame and fear follow dem forever  
and make dem die with disgrace.   
18 Den dem go know sey na only Yu bi God,  
di Pesin wey get pawa pass for di whole world.