4
Betta Life
Since Christ don sofa for us, make wi do like am, bikos di pesin wey sofa for us nor get anytin to do with sin again, bikos e don do wetin God wont and nor bi wetin pipol wont. Di time wey una dey bihave like unbilivers, don pass. Dat time una live bad life; dey do bad tins; dey drink; dey do anyhow and serve juju. Naw, doz unbilivers dey sopraiz and curse una, bikos una nor dey follow dem do bad and wiked tins again. For di day wen Christ go judge pipol wey dey alive and doz wey don die, e go ponish dem. Na dis make Christ prish di gospel for doz wey don die, so dat even doh e go judge dem as human being, dem go live forever as spirit thru God judgement.
Work, Sofa And Judgement
Di time wen evritin go end don near. So make una dey kontrol unasef and shine una eye wen una dey pray. As una dey do so, make una love for each oda dey strong, bikos love dey kover plenty sins. Make una welkom pipol for una house without komplain. 10 God don give evribody en own gift, so make una use di gift take help each oda as good savant wey get God grace. 11 Pesin wey dey prish; make e prish God word well. Pesin wey dey help odas, make e do am with di pawa wey God gi-am, so dat for evritin, God go get glory thru Jesus Christ. Make all glory and pawa bi Christ own forever and ever. Amen!
12 My friends, make una nor sopraiz sey una dey pass thru trobol like pesin wey fire dey burn, bikos tins wey go make una fear, go must happen. 13 Instead, make una dey happy as una dey sofa for Christ, so dat wen God go show una en glory, belle go sweet una. 14 If dem curse una bikos of Christ, God don bless una bi dat, bikos God Spirit wey get glory, rest on-top una life. 15 But make anybody among una nor sofa, bikos e kill, tif or curse trobol. 16 But if yu sofa bikos yu bi Christian, make yu nor shame, but dey praiz God, bikos yu dey ansa Jesus name. 17 Di time for judgement don rish and e go start with God pipol. And if e start with us, wetin go happen to pipol wey nor dey obey God? 18 If e go hard for God pipol to dey save, den e nor go eazy for doz wey nor dey fear God. 19 So if yu dey sofa as God wont am, make yu trust God wey kreate yu and E nor go ever fail yu.