5
God Pipol And Dia Leaders
Mi wey bi una fellow elder, wey si how Christ sofa and go share for God glory wey go soon kom, dey beg di eldas among una sey: Make una kare for di sheep wey God give una whole, just as shepad dey kare for dia sheep. Make e nor bi like sey dem force una do am, but na as God wont am. Una nor dey do am bikos of money, but na bikos una won do am. And make una nor dey opress God pipol wey dey under una, instead make una bi ezample to dem. So wen di big shepad, Jesus Christ go kom, e go give una crown wey en glory nor go ever fade.
For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol. Make una put una body for groun bikos of God and wen di rite time rish, E go karry una up. Make una karry all una trobol give God, bikos E kare for una. Make una shine una eye well-well, bikos devil wey bi una enemy, bi like hongry lion wey dey shaut and dey find who e go chop. Make una nor gi-am shance, but make una faith strong, bikos una know sey na di same tin una brodas and sistas for evriwhere for dis world, dey sofa. 10 Afta una don sofa small, God wey koll una with en grace enter en glory for Christ, go make una komplete, una leg go strong and una go get pawa. 11 Make all pawa bi God own forever and ever. Amen!
12 I tell my dear broda Silas sey, make e help mi rite dis small leta, so dat una heart go strong and make e tell una sey, all wetin dey happen to una, na as God wont am. So make una stand strong with en pawa. 13 God pipol for di church wey dey Babilon dey greet una and Mark, my pikin, dey greet una too. 14 Make una salot each oda with Jesus Christ love. Make peace dey with all of una wey dey inside Christ.