3
Husband And Wife
Make una wey bi wife, dey obey una husband. Even doh dem nor dey do wetin dem rite for God word, di way una dey bihave, fit make dem shange, wen dem si una good karata and how una life pure rish. Make una beauti nor bi di one wey pipol dey only si like: to dey plait hair; dey wear gold or fine klot. Instead make e show sey Christ dey inside una and una don get gentol and kwayet spirit wey God go value. Di wimen for olden days dey holy, bikos dem put dia hope for God hand and dem respet dia husband. As Sarah obey Abraham kon koll am, “My oga,” una go bi God pikin, if una dey do wetin good. Husbands, make una dey trit una wife with soft hand, bikos una know sey dem nor strong rish una; make una respet dem as pipol wey get God grace and life. If una dey do like dis, nor-tin go block una prayers.
Sofa Bikos yu Do Good
So, make una live for peace togeda, dey sorry for each oda; love one anoda and nor dey karry body up. Make una nor take bad pay di bad wey pesin do una, instead, make una bless odas, bikos God koll una to bless pipol. 10 God word sey:
Anybody wey won enjoy good life,
must kontrol en mout;
make e nor dey tok bad-bad tins or lie.
11 E must turn from di wikedness wey e dey do,
kon start to do good
and make e live for peace with evribody.
12 God dey si di pipol wey dey do good
and en ear dey open to hear dia prayers.
But E dey against pipol wey dey do bad.
13 Who go fit do yu bad tin, if yu dey do good? 14 But if yu sofa bikos yu dey do good, make yu nor fear doz wiked pipol, bikos God don bless yu bi dat. 15 For una heart, make una make Christ una Oga God and make una ready to ansa anybody wey ask una about di hope wey una get. 16 But make una do am with gentolness and respet, dey make sure sey una mind klean, so dat pipol wey dey tok bad about di good tins wey una dey do for Christ, go shame for di bad wey dem dey tok. 17 E betta to sofa for wetin good, dan for bad one if na so God wont am.
18 Bikos of sin, Christ sofa.
En wey nor do bad,
sofa for doz wey do bad,
so dat e go karry us go meet God.
And wen dem kill-am,
e wake-up as spirit.
19 As spirit, e kon go prish
give wiked pipol spirits wey dey prison,
20 bikos dem nor do wetin God tok. God get patient for dem wen Noah dey build di ark, but na only di eight pipol wey dey inside di ark save from di wota. 21 Dis show how baptizim go save us, nor bi just to wosh dirty komot for pesin body, but na to show sey wi get good mind for God thru di way wey Jesus Christ take raiz-up 22 go heaven kon go sidan for God rite hand, where e dey rule di angels and doz wey get pawa.