2
Stone Wey Dey Alive
Make una stop to do bad tin; dey deceive pipol, pritend; dey jealous and tok bad about pipol. But make una dey hongry for spiritual milk like pikin wey dem just born, so dat una faith go strong well-well and una go know how God salvashon good rish.
Una don kom meet Christ, wey bi di stone wey dey alive. Pipol rijet am, but God choose am and e dey important for God eye. So unasef too, don bi stone wey dey alive and God dey build una as en spiritual house, so dat una go bi priest wey dey holy and una go offa spiritual sakrifice wey E go asept thru Jesus Christ. God word sey, “Naw, I don lay one stone for Zion; di main stone wey I choose; no money fit buy am and anybody wey bilive am, nor go shame.” So, una wey bilive don know en value, but for di pipol and builders wey nor bilive, dat Stone don kon bi di main stone. Na-im bi di rock wey dey fall pipol, bikos dem nor fit jump am pass. As dem nor bilive God word, dem bigin fall, bikos na so E plan sey e go bi. But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite. 10 Before-before, una nor bi God pipol, but naw, una don bi en pipol. Dat time, God nor get mesi for una, but naw, una don get en mesi.
11 My friends, I dey beg una, since una bi strenjas for dis world, make una nor follow di tins wey pipol like to do, bikos dem dey distroy pesin soul. 12 So make una dey live well among pipol wey nor bi Christian, so dat wen dem sey una do bad, dem go si di good tins wey una dey do and dem go praiz God wen E won judge di world.
Obey Authority
13 Make una dey obey una leaders bikos of Christ. Weda dem bi kings wey get pawa 14 or govnors wey God choose sey, make dem ponish pipol wey do bad and praiz doz wey do good. 15 Bikos God wont sey, wetin una dey do, go make di pipol wey nor get sense shut up dia mout. 16 Make una live as free pipol and nor use una freedom as eskuse to do bad tins, but make una use am well as God savant. 17 Make una respet evribody. Love dis awa family wey bilive Christ. Make una fear God and respet di king.
18 Una wey bi slave, make una dey obey una oga, both di ones wey good or gentol and doz wey nor good. 19 If anybody bear pain bikos of God and dey sofa for wetin e nor do, God go favor am. 20 But why pipol go praiz yu wen dem ponish yu bikos of wetin yu do and yu bear-am? But if yu sofa bikos yu do good, God go favor yu, 21 bikos na wetin E koll yu to do, bi dat. Christ sofa as ezample wey una go follow 22 and e nor kommit any sin or lie. 23 Wen dem curse am, e nor ansa back; wen e sofa, e nor treaten sey e go pay dem back, but e put ensef for God hand wey nor dey judge kase with parsha. 24 E karry awa sin for cross, so dat wi go stop to sin and dey do good for God eye. “Na di wound wey dem wound am, naim make us well.” 25 Before-before, una waka komot for di rite road like sheep wey lost, but naw, una don turn back go meet di Shepad and Pesin wey dey guide una soul.