7
Nehemaya Choose Rulers
Afta wi don ribuild di wall and put all di gates for dia pozishon, I kon give doz wey dey guide di temple, doz wey dey sing for di temple and di oda Levi pipol, di work wey dem go do. I put two men make dem dey kontrol Jerusalem town and dem bi my brodas: Hanani and Hananaya wey dey kommand di strong house dem. Hananaya dey faithful and dey fear God well-well. I tell dem sey make dem nor dey open di gate for morning until aftanoon and make dem dey lock am before di guards go sleep for nite. I still tell dem sey make dem choose guards from among di pipol wey dey stay Jerusalem, make some stand for di gate, while odas go dey go round di aria and dia own house.
Jerusalem na big town, but di pipol wey dey stay inside nor plenty and dem neva build all di house finish. God put am for my heart sey make I koll all di pipol, dia leaders and ofisas togeda kon shek dia family rekord. I si di first set wey kom back from Babilon and dis na dia rekord:
Dis na di pipol for di aria wey kom back from Babilon since King Nebukadnezzar karry dem go der as prisonas. Dem go back to dia towns for Jerusalem and Judah. Di leaders wey kom back with dem na: Zerubabel, Jeshua, Nehemaya Nahamani, Zabud (Seraya), Reelaya, Mordekai, Bilshan, Mispar, Bigvai, Rehum and Baanah.
Dis na di list of each family for Israel and di nomba of pipol wey from each family kom back from Babilon na:
Parosh family wey bi 2,172;
Shefataya family and dem bi 372;
10 Arah family and dem bi 652;
11 Pahat-Moab (Jeshua and Joab shidren-shidren) and dem bi 2,818;
12 Elam family and dem bi 1,254;
13 Zattu family and dem bi 845;
14 Zakkai family and dem bi 760;
15 Binnui (Bani) family and dem bi 648;
16 Bebai family and dem bi 628;
17 Azgad family and dem bi 2,322;
18 Adonikam family and dem bi 667;
19 Bigvai family and dem bi 2,067;
20 Adin family and dem bi 655;
21 Ater, (Hezekaya pikin-pikin) family and dem bi 98;
22 Hashum family and dem bi 328;
23 Bezai family and dem bi 324;
24 Harif family and dem bi 112;
25 Gibeon family and dem bi 95.
26 Betlehem and Netofat men na 188;
27 Anatot men na 128;
28 Bet-Azmavet family men na bi 42;
29 Kiriat-Jearim, Kefirah and Beerot men na 743;
30 Rama and Gibeah men na 621;
31 Mikmash men na 122;
32 Bethel and Ai men na 123;
33 Nebo men for west na 52;
34 Elam family for west na 1,254;
35 Harim family na 320;
36 Jeriko family na 345;
37 Lod, Hadid and Ono family na 721;
38 Hassenaah family na 3,930.
39 Di priests family wey kom back from Babilon na: Jedaya (Jeshua shidren-shidren) family and dem bi 973;
40 Imma family na 1,052;
41 Pashhur family na 1,247;
42 Harim family na 1,017.
43 Levi family wey kom back from Babilon na:
Jeshua (Kadmiel wey Hodevah en papa, na en shidren-shidren) family and dem bi 74.
44 Doz wey dey sing for di temple (Asaf shidren-shidren)
family na 148.
45 Doz wey dey guide di temple (Shallum, Ater, Talmon, Akkub, Hatita and Shobai shidren-shidren)
dia family na 138.
46 Di pipol wey dey work for di temple, dia family wey kom back from Babilon na:
Ziha family, Hasufa family, Tabbaot family,
47 Keros family, Sia family, Padon family,
48 Lebanah family, Hagabah family, Shamlai family,
49 Hanan family, Giddel family, Gahar family,
50 Reaaya family, Rezin family, Nekoda family,
51 Gazzam family, Uzza family, Paseah family,
52 Besai family, Meunim family, Nefusim family,
53 Bakbuk family, Hakufa family, Harhur family,
54 Bazlut family, Mehida family, Harsha family
55 Barkos family, Sisera family, Temah family,
56 Nezaya family and Hatifa family.
57 Solomon savants family wey kom back from Babilon na:
Sotaya family, Soferet family, Perida family,
58 Jaala family, Darkon family, Giddel family,
59 Shefataya family, Hattil family,
Pocheret-Hazrebaim family and Amon family.
60 All di temple savants and Solomon savants shidren-shidren wey kom back na 392. 61 Dis na di ones wey kom from Tel-Melah, Tel-Harsha, Kerub, Addon and Imma (even doh sey dem nor fit show weda dem really kom from Israel tribe):
62 Delaaya family, Tobaya family and Nekoda family and dem bi 642.
63 Dis na some among di priests family wey nor get rekord to show sey dem bi Israel pipol:
Hobaaya family, Hakkoz family, Barzillai (wey marry one of Barzillai dotas, wey bi Gilead pesin kon shange en name to en wife papa name) family.
64 Since dem nor fit show who dia grand-grand papa bi, dem nor kon asept dem as priests. 65 So di govnor tell dem sey dem nor go fit chop di food wey dem offa give God, until dem si priest wey go fit use Urim and Tummim.
66 Di total pipol wey kom back from Babilon na 42,360.
67 Dia men and wimen savant na 7,337. Dia men and wimen wey dey sing na 245. 68 Dia horse na 736, melu na 245, 69 Kamels na 435 and dia donkey na 6,720.
70 Some among di leaders for each family kollect ofrin on dia own wey dem join take do di work. Di govnor give 1,000 gold koin, 50 gold basin and 530 garment for di priest. 71 Some among di family leaders give 20,000 gold koin and 2,200 pound for silva. 72 Wetin di remainin pipol give rish, 20,000 pound for gold, 2,000 pound for silva and 67 garment for di priests.
73 Di Priest, Levi pipol, doz wey dey guide di gate, doz wey dey sing, di temple savants and evry oda pesin for Israel kon stay for di town. So for di sevent monts, Israel pipol kon start to stay for dia towns.