8
Ezra Read Di Law
All of dem gada for Jerusalem for one hall wey dey di Wota Gate front. Dem kon tell Ezra wey sabi di law sey make e go bring di Law Book wey God give Israel thru Moses.
So Ezra wey bi priest karry am kom where di pipol gada put, both men, wimen and shidren wey don get sense. E read di law for di hall wey dey near di gate from morning go rish aftanoon and all of dem listin well-well.
Ezra stand on-top stage wey dem build, bikos of dis meetin. Di men wey stand for en rite side na: Mattitaya, Shema, Anaya, Uriaya, Hilkaya and Maaseaya, while di men wey stand for en left na: Pedaaya, Mishael, Malkijah, Hashum, Hashbaddanah, Zekaraya and Meshullam.
As Ezra stand on-top di stage, all di pipol kon dey look am. All of dem stand up as e just open di book. Ezra kon sey, “Make wi praiz di Oga wey bi di great God!” All di pipol raiz dia hand go up kon ansa, “Amen! Amen!” Dem knee down, bow and woship God.
Afta, Levi pipol wey bi: Jeshua, Bani, Sherebaya, Jamin, Akkub, Shabbetai, Hodaya, Maaseaya, Kelita, Zabud, Jozabad, Hanan and Pelaaya kon esplain di law give di pipol wey stand der dey listin. Dem read and esplain God law, so dat di pipol go undastand am.
Wen di pipol hear wetin dem read for di law, di word tosh dem sotey dem kon start to kry. So Nehemaya wey bi di govnor, Ezra wey bi priest wey know di law well-well and Levi pipol wey dey esplain di law kon tell all di pipol, “Today dey holy for di Oga wey bi una God, so una nor suppose mourn or kry.
10 “Naw, make una go house go celebrate. Share food and wine with pipol wey nor get. Today na holy day for awa Oga God, so make una nor kry, bikos na God happiness dey make una strong.”
11 Levi pipol kon go round dey tok to di pipol make dem nor kry, bikos today na holy day.
12 So all di pipol go dia house dey happy, dey chop and drink and share wetin dem get with one anoda, bikos dem undastand wetin dem read give dem.
13 Di next day, di head for each family, with di priests and Levi pipol go meet Ezra wey know di law well-well so dat e go really tish dem. 14 Dem si sey, Moses rite for God Law sey, make Israel pipol stay for shelta wen ever dem dey do di feast for di sevent mont. 15 So dem make and send dis kommand go round Jerusalem and di oda village and towns sey: “Make una go di hills go kut wood kom from olive, myrtle, palm and oda trees make wi take build where wi go stay celebrate di festival, just as dem rite am for di law.”
16 So di pipol go kut palm leaf take kover dia house, di temple kourtyard and di field wey dey near di Wota Gate and Efraim Gate. 17 All di pipol wey kom back from Babilon build house kon dey stay der. Dis na di first time wen dem dey do am afta di time wey Nun pikin, Jeshua do am and evribody happy well-well.
18 From di first day wey di festival start go rish di end, dem dey read one-one part from God law evriday. Dem celebrate for seven days kon finish di festival for di eight day, just as dem rite am for di law.