6
Pipol Oppoz Nehemaya
Wen Sanballat, Tobaya, Geshem and di rest of awa enemies hear sey wi don build di wall tight well-well, even doh wi neva set di gates for where dem suppose dey, dem kon send message kom give mi sey make I kom meet dem for one village for Ono field.
But I kon know sey dem dey plan to attack mi. So I send message to dem sey, “I get betta work wey I dey do, so I nor go fit kom. I nor go fit stop di work, bikos I won kon si una.” Dem send mi di same message four times and each time dem send am, I dey give dem di same ansa.
For di fift time, Sanballat send one savant with leta kon give mi. Dis na wetin dem rite for di leta:
“Geshem tell mi sey, dem dey tok for evriwhere sey yu and Jew pipol won kom attack us and na dis make yu dey build di wall back. E still sey yu dey plan to make yorsef king and yu don arrange with some profet make dem announce for Jerusalem sey yu bi Judah king. Naw, di king go hear about am and na dis make mi sey make yu kom make wi first tok about di matter.”
I ansa am, “All wetin yu tok so, nor bi true. Na only yu arrange dis story.”
I si sey dem dey won make us fear, so dat wi go stop di work.
But I pray kon sey, “My Oga God, make Yu give mi strent!”
10 By dis time, I go visit Shemaya wey Mehetabel pikin Delaaya born, wey nor fit komot from en house. Den e tell mi, “Mi and yu must go hide for di Holy Place for di temple kon lock di doors, bikos dem won kon kill yu. Dem go kom kill yu anytime from naw.”
11 I ansa, “I nor bi di kind pesin wey dey run go hide. Yu tink sey I go won save my life kon go hide for di temple? I nor go do am.” 12 Wen I tink am again, I just know sey God nor tok to Shemaya, but na Sanballat and Tobaya bribe am make e for tok wetin e dey tok so. 13 Dem hire am make e for make mi fear den kon sin, so dat dem go spoil and disgrace my good name.
14 I kon pray, “My God, remember wetin Sanballat and Tobaya dey do, den make Yu ponish dem. Remember and ponish dat woman Noadaya and all di oda profets wey dey won make mi fear.”
Dem Build Jerusalem Finish
15 Afta wi don work for fifty-two days, wi finish di hole wall for di twenty-fifth day for Elul (October) mont. 16 Wen awa enemies wey dey di nashons wey surround us hear am, shame katch dem, bikos evribody know sey na God help us do di work.
17 For all dis time, Jew leaders dey rite and receive letas from Tobaya. 18 Many pipol for Judah dey en side, bikos en fada-in-law na Jew wey bi Shekanaya wey bi Arah pikin. En pikin Jehohanan marry Meshullam wey bi Berekaya dota. 19 Pipol go dey tok for my front about all di good tins wey Tobaya dey do kon go tell am evritin wey I tok. But e still kontinue to dey send mi leta wey go make mi fear.