11
Jerusalem Pipol
Di pipol leaders kon dey stay for di holy town for Jerusalem and if dem divide di pipol for Judah and Benjamin town into ten, na one part dey stay der, while di rest dey stay where dem dey before. Di pipol tank di ones wey sey dem go stay for Jerusalem.
Dis na di ofisas wey kom stay Jerusalem. (Some of di pipol, Levi pipol, priests, temple savants and Solomon savants shidren-shidren still dey stay dia own house for di difren towns wey dey Judah, but some among di pipol for Judah and Benjamin go back to Jerusalem, na dem bi.)
From Judah tribe: Uzzaya wey Zekaraya pikin Ataya born and na Amaraya born Zekaraya. Na Shefataya wey Perez pikin Mahalalel born, bi Amaraya papa. Wi still get Maaseaya wey bi Baruk pikin and na Kol-Hozeh wey Hazaya born, bi Baruk papa. Hazaya na Adaya pikin wey Joiarib born and na Zekaraya wey Shelah born, bi Joiarib papa. Perez shidren-shidren wey dey for Jerusalem na 468 and all of dem na betta men.
From Benjamin tribe: Wi get Sallu wey Meshullam born, wey Joed born, wey Pedaaya born, wey Kolaya born, wey Maaseaya born, wey Itiel born, wey Jeshaya born. Pipol wey follow am na Gabbai and Sallai and dia family na 928. Na Joel wey Zikri born bi dia oga and na Hassenuah pikin, Judah bi next afta am for di town.
10 From di priest: Wi get Jedaya wey bi Joiarib pikin and Jakin 11 and Seraya wey Meshullam pikin, Hilkaya born. En grand-papa dem na Zadok, Meraiot and Ahitub wey dey guide God Temple. 12 Wi still get 822 pipol wey dey work with am for di temple. Wi get Adaya wey Jeroham born, wey Pelalaya born, wey Amzi born, wey Zekaraya born, wey Pashhur born, wey Malkijah born 13 with 242 pipol wey bi head for dia family. Wi still get Amashsai wey Azarel born, wey Ahzai born, wey Meshillemot born, wey Imma born 14 and 128 of en strong men follow am. Di pesin wey dey lead dem na Zabdiel wey Haggedolim born.
15 From Levi tribe: Wi get Shemaya wey Hasshub born, wey Azrikam born, wey Hashabaya born, wey Bunni born. 16 Wi still get Shabbetai wey Jozabad born, wey bi oga for di work wey dem dey do outside God Temple. 17 Wi still get Matanaya wey Mikah born, wey Zabdi, Asaf pikin born and na-im dey lead di tanksgivin and prayer. E still get Bakbukaya wey dey support Matanaya and Abda wey Shammua born, wey Galal born, wey Jedutun born. 18 All di Levi pipol for di holy town na 284.
19 Among doz wey dey guide di gate: E get Akkub, Talmon and 172 pipol.
20 God priests, Levi pipol and di rest pipol for Israel dey stay where dia family land dey for Judah.
21 But doz wey dey serve for di temple dey stay for Ofel Hill and dia leaders na Ziha and Gishpa.
22 Di main Levi pipol oga for Jerusalem na Uzzi wey Bani born, wey Hashabaya born, wey Matanaya born, wey Mikah wey bi Asaf grand-pikin born and na en family dey sing for God Temple. 23 Dem dey do evritin as e suppose bi evriday, just as dem rite am for di royal kommand wey dem dey follow.
24 Petahaya wey Meshezabel born wey dey among Zera shidren-shidren from Judah tribe, na-im dey advise di king for all di matter wey koncern how to rule and kontrol di pipol.
25 But for di village around dia fields, some among di pipol for Judah dey stay Kiriat-Arba, Dibon and Jekabzeel with di place and village wey dey der. 26 Dem still dey stay for Jeshua, Moladah, Bet-Pelet, 27 Hazar-Shual, Beersheba and di village for 28 Ziklag, Mekona and dia village. 29 Dem still dey stay En-Rimmon, Zorah, Jarmut, 30 Zanoah and Adullam with di village wey dey der. Dem still dey Lakish with di field wey dey near der and Azeka with en village. So Judah pipol stay from Beersheba go di sout valley for Ben-Hinnom.
31 Some pipol from Benjamin tribe dey stay for Gibeah, Mikmash, Aija and Bethel with di arias for der. 32 Dem still dey stay for Anatot, Nob, Ananaya, 33 Hazor, Rama, Gittaim, 34 Hadid, Zeboim, Neballat, 35 Lod, Ono and Wise Men Valley.
36 So, dem send some among Levi pipol wey dey Judah go join Benjamin pipol.