10
Di pipol wey sign na:
Nehemaya wey bi govnor, Hakalaya pikin, and
Zedekaya sign too. Di oda pipol wey still sign na: Di priests: Seraya, Zabud, Jeremaya,
Pashhur, Amaraya, Malkijah,
Hattush, Shebanaya, Malluk,
Harim, Meremot, Obadaya,
Daniel, Ginneton, Baruk,
Meshullam, Abijah, Mijamin,
Maazaih, Bilgai and Shemaya.
Levi pipol wey sign na:
Jeshua wey Azanaya born, Binnui from Henadad family, Kadmiel, 10 Shebanaya,
Hodaya, Kelita, Pelaaya, Hanan,
11 Mikah, Rehob, Hashabaya,
12 Zakkur, Sherebaya, Shebanaya,
13 Hodaya, Bani and Beninu.
14 Di leaders wey sign na: Parosh, Pahat-Moab, Elam, Zattu, Bani,
15 Bunni, Azgad, Bebai, 16 Adonijah, Bigvai, Adin,
17 Ater, Hezekaya, Azzur,
18 Hodaya, Hashum, Bezai,
19 Harif, Anatot, Nebaya,
20 Magpiash, Meshullam, Hezir,
21 Meshezabel, Zadok, Jaddua,
22 Pelataya, Hanan, Anaya,
23 Hoshea, Hananaya, Hasshub,
24 Hallohesh, Pilha, Shobek,
25 Rehum, Hashabnah, Maaseaya,
26 Ahijah, Hanan, Anan,
27 Malluk, Harim and Baanah.
Di Agriment
28 Naw di remainin Israel pipol, di priests, Levi pipol, doz wey dey guide, sing and work for di temple and evribody wey obey God law kon separate demsef from doz strenjas wey dey stay for di town. Both wi, awa wifes and shidren wey don get sense to undastand, 29 join hand with awa leaders kon swear sey, make curse dey awa head if wi nor live akordin to God law. Di law wey E give us thru en savant Moses wen e sey make wi obey evritin wey di Oga awa God kommand us kon keep all en rules and regulashons.
30 Wi promise sey awa dota nor go marry di strenjas wey dey stay for awa land.
31 Wi still promise sey wi nor go buy korn or anytin wey strenjas go karry kon sell for us for Sabat Day or for any oda day wey holy. For evry sevent year, wi nor go plant anytin for di land and wi go kounsol all di debt wey pipol dey owe us.
32 Evry year, wen wi divide awa silva into eight, wi go drop one part for di temple work. 33 Anytime dem dey woship for di temple, wi go provide dis tins: di holy bread, di korn wey dem dey give evriday as ofrin, di animals wey dem go burn as sakrifice for each day, di holy ofrins for Sabat Day, di new moon festivals and oda festivals, di oda holy ofrins, di ofrin wey go remove Israel sins and anytin wey dem nid for di temple.
34 Wi, di pipol, di priests and Levi pipol, go trow dice evry year to know di family wey go dey burn di sakrifice wey dem offa give di Oga awa God, akordin to wetin dey di law.
35 Evry year, wi go take di first korn wey wi harvest go di temple as ofrin and even di first fruit wey go ripe for awa trees, wi go give dem too.
36 Wi go karry di first boy pikin wey awa wife born go meet di priest for di temple and dem go dedikate am give God, just as dem rite am for di law. Wi go still dedikate di first melu, sheep, lamb and goat wey awa animals go born.
37 Di bread wey wi make from di first korn wey wi harvest for each year and oda ofrin like wine, olive oil and difren kind of fruits, wi go-go give dem to di priest for di temple. Wi go give Levi pipol one out of evry ten tins wey wi get from evritin wey wi plant for awa farm, bikos na dem dey kollect am. 38 One priest wey kom from Aaron shidren-shidren must dey with Levi pipol wen dem dey kollect tithe and Levi pipol go bring one from evry ten tins wey dem kollect kom keep am for di store for awa Oga God Temple. 39 Israel and Levi pipol must take di korn, wine and olive oil wey dem kontribute go keep for di temple where dem dey keep tins put and where di priest wey dey duty, doz wey dey guide and sing for di temple dey stay.
Wi nor go forget awa Oga God house.