12
Di Priest And Levi Pipol
Di priests and Levi pipol wey kom back from Babilon with Shealtiel pikin Zerubabel and Jeshua wey bi di High Priest na: Seraya, Jeremaya, Ezra, Amaraya, Malluk, Hattush, Shekanaya, Rehum, Meremot, Iddo, Ginnetoi, Abijah, Mijamin, Moadaya, Bilgah, Shemaya, Joiarib, Jedaya, Sallu, Amok, Hilkaya and Jedaya. Dis na di leaders among di priest and doz wey dey work with dem wen Jeshua bi di High Priest.
Levi pipol wey kom back with dem na: Jeshua, Binnui, Kadmiel, Sherebaya, Judah and Matanaya and na dem with dia pipol dey sing dey tank God. Di pipol wey follow dem na Bakbukaya and Unni and dem dey stand opposite dem wen di service dey go on.
10 Jeshua wey bi di High Priest na Joiakim papa. Joiakim na Eliashib papa and Eliashib na Joiada papa. 11 Joiada na Jonatan papa and Jonatan na Jaddua papa.
12 So wen Joiakim na High Priest, doz wey dey lead for di priest family na: Meraaya wey dey lead Seraya family; Hananaya wey dey lead Jeremaya family; 13 Meshullam wey dey lead Ezra family; Jehohanan wey dey lead Amaraya family; 14 Jonatan wey dey lead Malluk family; Josef wey dey lead Shebanaya family; 15 Adna wey dey lead Harim family; Helkai wey dey lead Meraiot family; 16 Zekaraya wey dey lead Iddo family; Meshullam wey dey lead Ginneton family and 17 Zikri wey dey lead Abijah family. Dem still get one leader for Mijamin family. Piltai dey lead Moadaya family; 18 Shammua dey lead Bilgah family; Jonatan dey lead Shemaya family; 19 Mattenaya dey lead Joiarib family; Uzzi dey lead Jedaya family; 20 Kallai dey lead Sallu family; Eber dey lead Amok family; 21 Hashabaya dey lead Hilkaya family and Netanel wey dey lead Jedaya family.
22 Dem keep one book about Levi family for di time wen Eliashib, Joiada, Johanan and Jaddua dey serve as High Priest. Anoda rekord for di priest dey for di time wen Darius dey rule Persia. 23 Di head for Levi family rite dia names put for di history book until di time wey Eliashib grand-pikin, Johanan dey rule. 24 Dis na di family leaders for Levi tribe: Hashabaya, Sherebaya, Jeshua, Binnui, Kadmiel and di oda men wey dey stand face dem wen dem dey do di praiz and tanksgivin service and just as David wey dey serve God kommand dem, one group dey praiz with di oda group.
25 Dem bi Matanaya, Bakbukaya and Obadaya. Na Meshullam, Talmon and Akkub dey guide di gate and di store room for di gates. 26 All dis men serve for di time wen King Joiakim wey Jehozadak pikin Jeshua born, dey rule and dat time Nehemaya na govnor, while Ezra na priest.
Dem Dedikate Jerusalem
27 Wen dem won dedikate di new wall for Jerusalem, dem sey make Levi pipol from evriwhere for di land kom Jerusalem kon support dem for di party. Dem sey make dem join for dis serimony as dem dey sing and tank God with dia cymbals, harp and lyres. 28 Dem bring doz wey dey sing from evriwhere for Jerusalem and from di village dem wey dey Netofat. 29 Dem still kom from Bet-Gilgal and di poor arias near Gibeah and Azmavet, bikos doz wey dey sing don build dia own house round Jerusalem. 30 Di priest and Levi pipol first santify demsef; den dem kon santify di pipol, di gates and di wall.
31 I take di leaders for Judah go on-top di wall kon organize two big kwaya wey go give tanks. One among di kwaya face sout for di Dirty Gate. 32 Hoshaaya and half for di leaders for Judah follow dem, 33 with Zabud, Ezra, Meshullam, 34 Judah, Benjamin, Shemaya and Jeremaya. 35 Den some priest wey dey blow trumpet kon kom with Zekaraya wey Jonatan born, wey Shemaya born, wey Matanaya born, wey Mikaya born, wey Zakkur wey kom from Asaf shidren-shidren, born. 36 Zekaraya friends na Shemaya, Azarel, Milalaya, Gilalai, Maai, Netanel, Judah and Hanani and dem dey use di music instrument wey God savant, David give dem. Na Ezra bi di kwayamasta. 37 For di Well Gate, dem klimb go di town wall wey face David Town. Dem pass David house kon dey waka go di Wota Gate for east.
38 Di sekond kwaya wey dey tank God kon go di nort side thru di oda side make dem for meet di oda pipol. I follow dem with di oda half of di leaders, on-top di wall until wi pass Ovens Towa go rish di Broad Wall, 39 den wi pass Efraim Gate till wi rish di Hundred Towa. Wi waka go rish di Sheep Gate kon stop for di Guide Gate.
40 Di two kwaya wey dey give tanks kon go awa Oga God Temple, den dem take dia pozishon. So mi and all di group leaders kon sidan. 41 Wi follow di priests wey dey blow di trumpet and dem bi: Eliakim, Maaseaya, Mijamin, Mikaya, Elioenai, Zekaraya and Hananaya 42 and doz wey dey sing na: Maaseaya, Shemaya, Eleazar, Uzzi, Jehohanan, Malkijah, Elam and Ezer. Dem play kon dey sing well-well and na Jezrahaya bi di kwayamasta. 43 For dat day wen pipol dey happy, dem offa many sakrifice, bikos God don give di pipol rizin to dey happy. Di wimen and shidren still join for di celebrashon and evribody from far know sey betta tin dey happen for Jerusalem.
44 Dat day, dem kon pick men wey go dey guide di store room for di ofrins, di first part for di harvest and one out of evry ten tin wey dem give God. Na dem dey kollect money from di field outside di town and di part wey di law give di priest and Levi pipol. All di pipol for Judah dey happy, bikos of di work wey Levi pipol and di priests dey do. 45 Dem dey do dia God work kon santify pipol, just as David and Solomon en pikin kommand and doz wey dey sing and guide di gate, dey do di same tin too. 46 Di tradishon to get kwayamasta wey go lead di pipol for praiz, hymns and tanksgivin don start since David and Asaf time. 47 So naw, for Zerubabel and Nehemaya days, evribody for Israel dey bring food evriday for doz wey dey sing, guide di gate and for Levi pipol. Levi pipol dey still give part of wetin dem kollect to di priests wey bi Aaron shidren-shidren.