3
John Tok About Love
Make una si di kind love wey awa God get for us. And naw, pipol dey koll us God shidren and true-true, na God shidren wi bi. Di world nor know us, bikos dem nor know am. My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi. And evribody wey get dis hope for Christ, dey make ensef pure, just as Jesus dey pure.
Evribody wey dey like to sin, nor dey obey God law and to sin, na to disobey God law. And una know sey God send Jesus kom, make e for karry sin komot and know sin dey inside Christ. Anybody wey dey stay inside am nor dey like to sin, but pesin wey dey kommit sin, neva si or know am. So my shidren, make una nor let anybody deceive una: If pesin dey do wetin good for God eye, dat show sey dat pesin dey good, just as Christ dey good for God eye. But pesin wey dey like to sin, na devil pikin, bikos devil dey sin from di biginnin. Na dis one make God Pikin kom dis world, so dat e go skata all di work wey devil dey do. Pesin wey bi God pikin, nor dey like to sin, bikos God seed dey inside am. 10 Na like dis una go take know God and devil shidren. Pesin wey nor dey do wetin good for God eye and nor love en broda or sista for Christ, nor bi God pikin.
11 Dis na di Good News wey una don hear from di biginnin sey, “Make wi love each oda as awasef.” 12 Nor bi like Kain wey bi devil pikin, wey kill en broda. And wetin make am kill-am? Na bikos God nor asept en ofrin as E asept Abel own.
13 So my brodas and sistas, make una nor sopraiz sey dis world pipol hate una. 14 Wi know sey wi don cross from deat enter life, bikos wi dey love and kare for awa brodas and sistas for Christ. 15 Pesin wey hate en broda or sista for Christ, fit kill pesin and di life wey nor go end, nor dey inside am. 16 Dis na wetin make us know wetin love bi: Jesus Christ die for us, so wi suppose sakrifice awa life for awa fellow Christian brodas and sistas. 17 But pesin wey get enough tins and e nor sorry for en broda or sista for Christ wey nor get at-all, na how God love go take dey inside am?
18 My shidren, make wi nor dey love with only word for mout, but make wetin wi dey do, show sey wi really love each oda. 19 Wetin wi dey do go show sey wi dey live for di trut, so wi go dey bold wen wi stand for God present. 20 So, even if awa mind kondemn us, wi know sey God big pass awa mind and E know evritin. 21 My friends, if awa mind nor kondemn us, awa heart go strong for God present 22 and anytin wey wi ask from am, E go give us, bikos wi dey do wetin E wont and na dis tins dey make belle sweet am. 23 Na wetin E kommand bi dis, “Make wi bilive en pikin Jesus Christ name and make wi love each oda, even as E don kommand us.” 24 So anybody wey do all wetin God tok, dey inside am and God dey inside dat pesin too. Wi know sey E dey inside us, bikos di Spirit wey E give us, dey stay inside us.