4
Make Una Try All Spirit
My friends, make una nor bilive evribody wey sey na God Spirit dey tok thru am. Una must test am to know weda na God Spirit e really get. Bikos many fake profets dey for dis world. Dis na how una go take know God Spirit: If pesin bilive sey na Jesus bi di Mezaya, wey kom as human being, dat pesin get God Spirit. But evribody wey nor gri sey Jesus na Oga God, dat pesin spirit nor kom from God. Dat na di anti-Christ spirit wey una hear sey dey kom and e don already dey dis world.
My shidren, una kom from God and una don get viktory ova doz pipol, bikos di pesin wey dey inside una, big pass di pesin wey dey di world. Dem kom from dis world: so dem dey tink like pipol for di world and di pipol wey dey di world, dey listin to dem. Wi kom from God and di pesin wey know God dey listin to us, but pesin wey nor know God, nor dey gri with us. Dis na how wi take dey know di thru Spirit and di spirit wey dey deceive pipol.
To No God True Love
My friends, make wi love one anoda, bikos love kom from God and anybody wey love odas, na God pikin and e know God, but pesin wey nor love en broda nor know God, bikos God na love. Dis na how God love dey show for awa life: God send en only Pikin wey E born, make e kom dis world, so dat thru am, wi go get life wey nor dey end. 10 Na dis bi love: nor bi sey wi first love God, but na-im first love us wen E send en Pikin kom die for us as sakrifice wey make am forgive us awa sins.
11 My friends, if God love us like dis, den wi must love each oda. 12 Nobody don ever si God before. If wi love each oda, God dey inside us and en love dey pafet inside us. 13 God don give us en Spirit to show sey wi dey inside am and e dey inside us. 14 Wi don si with awa eye sey, di Papa send en Pikin to bi Savior for di world.
15 If anybody sey Jesus na God Pikin, dat show sey, God dey inside am and e dey inside God too. 16 Wi know and bilive sey, God love us and en love dey inside us. 17 And as wi dey stay inside God, awa love dey grow more-more. So wi nor go fear for judgement day, but wi go face God with konfident, bikos wi live like Jesus Christ wen wi dey di world. 18 Dis kind love nor get fear, bikos betta love dey drive fear komot from pesin heart. If wi dey fear bikos wi nor wont make God ponish us, dat show sey wi neva really know how en love bi. 19 Bikos God first love us, naim make us dey fit love each oda.
20 If somebody sey, “I love God” and e hate en Christian broda, e dey lie, bikos pesin wey nor love en Christian broda wey e dey si, how e wont take love God wey e nor dey si? 21 God don kommand us sey: “If anybody love mi, make e love en broda and sista for Christ too.”