2
Na Christ Dey Tok For Us
(My shidren, I dey rite about dis matter, so dat una nor go dey sin.) But if anybody sin, wi get pesin wey dey beg di Papa for us, dat pesin, na Jesus Christ wey dey raitious and na en ensef bi di sakrifice wey God nid to forgive us awa sins. Nor bi only awa sin, but di sin wey di whole world dey kommit.
Wen wi do wetin God sey make wi do, den wi go dey sure sey wi know am. Di pesin wey sey, “I know God” and e nor dey do wetin God tok, dat pesin dey lie and di trut nor dey inside am. But anybody wey do wetin dem rite for God word, true-true, God word really dey inside am. Na dis go make us know sey wi dey inside God. Di pesin wey sey en with God dey togeda forever, dat pesin suppose live en life as Christ live en own.
Una wey bi my friends, I nor dey rite new kommandment give una, na di old one wey una get from di biginnin, I still dey rite and una don hear dem before. But dis new kommandment wey I dey rite give una so, naim bi di trut wey dey show inside Christ and inside una, bikos darkness don pass and di real lite don dey shine. Pesin wey sey e dey inside di lite, but e still hate en broda or sista for Christ, dat pesin still dey inside darkness. 10 Pesin wey love en broda or sista for Christ, dey live inside di lite and nor-tin go make am fall. 11 But di one wey hate en broda or sista for Christ, dey for darkness and e nor know where e dey go, bikos darkness don blind en eye.
12 My shidren, I dey rite give una sey God don forgive una sins, bikos of Jesus name. 13 I dey rite give una wey bi papa, bikos una know di pesin wey dey alive since God kreate di world. I dey rite give una wey bi yong pipol, bikos una don win Satan. 14 I don rite give una, my shidren, bikos una don know God. I don rite give una wey bi papa, bikos una don know di pesin wey dey alive since God kreate di world. I don rite give una yong pipol, bikos una dey strong and God word dey inside una, as una don win Satan.
15 Make una nor love dis world or di tins wey dey inside am. If anybody love dis world, di Papa love nor dey inside am, 16 bikos evritin wey dey inside di world (tins wey human being body wont; tins wey dey hongry pesin to get and to dey karry body up), nor kom from di Papa, but na dis world dem from kom. 17 And dis world don dey fade with di tins wey pipol wont, but di pesin wey dey do wetin God wont, go dey forever.
Warnin About Anti-Christ
18 My shidren, di world don dey end and just as una hear sey, anti-Christ dey kom, make una know sey many anti-Christ don already kom. And dis show us sey di world go soon end. 19 Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.
20 But di pesin wey dey holy, don anoint una and all of una know sey na true. 21 I nor rite give una, bikos una nor know di trut, but na bikos una know Christ and di trut dey stay inside am. 22 Na who dey lie? Na di pesin wey sey Jesus nor bi di Mezaya! Di pesin wey rijet di Papa and en Pikin, na Christ enemy. 23 Anybody wey rijet di Pikin, nor get di Papa. But if pesin asept di Pikin, e don asept di Papa too.
24 As for una, wetin una don hear from di biginnin, make una let am stay inside una. If wetin una hear from di biginnin stay inside una, una go stay inside di Pikin and en Papa. 25 Dis na di promise wey Christ ensef promise us sey, di life wey e go give, nor go ever end. 26 Na dis tins I dey rite give una about pipol wey dey try to deceive una.
27 As for una, di Holy Spirit wey Christ give una, dey stay inside una, so una nor nid anybody to tish una again. Evritin wey di Holy Spirit dey tish, na true and lie nor dey inside. Just as e don tish una, make una stay inside am.
28 Naw my shidren, make una stay inside am, so dat wen E kom, awa heart go dey strong well-well and shame nor go make us run from where E dey. 29 If una know sey E dey raitious, den una go know sey, doz wey dey do wetin God wont, na en shidren dem bi.