26
Isaak Stay Gerar
Honga kon dey di land, just as e happen for Abraham time. So Isaak kon go Gerar where Abimelek wey bi Filistia pipol king dey stay. God appear to Isaak kon tell am, “Make yu nor go Egypt; but make yu stay for di land wey I go show yu. Stay for dis land. Den I go dey with yu kon bless yu, bikos I go give all dis land to yu and yor shidren-shidren. I go do wetin I promise yor papa Abraham. I go make yor shidren plenty like di stars wey dey di sky and I go give dem all dis land. I go bless all di nashon for di world with yor shidren-shidren name. All dis tins go happen, bikos Abraham obey mi kon keep all my words; my kommand, my rules and my laws.” So Isaak kon stay for Gerar. Wen di men for di place ask am about en wife, e kon tell dem sey, “Na my sista.” Fear nor fit let am sey, “Na my wife,” bikos e tink for en mind sey, “If I sey na my wife, di men for dis place go kill mi make dem for fit get Rebekah, bikos e too fine.” Afta Isaak don stay der tey, Abimelek wey bi Filistia pipol king kon look from window and e si Isaak dey play with en wife Rebekah.
So Abimelek koll Isaak kon sey, “Dis woman na yor wife! Wetin make yu sey, ‘Na my sista e bi?’ ”
Isaak ansa, “Na bikos I tink sey somebody fit kill mi just to get am.”
10 Den di king sey, “Wetin make yu do us like dis? Wot of if one of my men kon go sleep with yor wife? Den yu for don make us sin!” 11 So Abimelek kommand all en pipol sey, “Anybody wey tosh dis man or en wife, must die.”
12 Isaak harvest plenty well-well and e rish hundred times of wetin e plant dat same year, bikos God don bless am. 13 Isaak kon rish well-well. E dey prosper more-more until evribody know am. 14 E get many sheep and kattle and en savant many well-well, so Filistia pipol kon dey jealous am. 15 So Filistia pipol karry san-san kon kover all di well wey Isaak papa savants, dig for di time wey Abraham dey der.
16 Den Abimelek kon tell Isaak, “Make yu komot from here go anoda place, bikos di pawa wey yu get, don strong pass awa own.”
17 So Isaak komot der kon go stay for Gerar Valley. 18 Isaak kon open di well again wey en papa Abraham dig wey Filistia pipol kover afta Abraham don die. Isaak give dis well di same name wey en papa gi-am before. 19 Wen Isaak savant dig for di valley kon si well wey get fresh wota, 20 di men for Gerar kworel with Isaak men kon dey sey, “Na wi get di wota!” So Isaak koll di well Esek, bikos dem follow am drag am.
21 En savants dig anoda well, but dem still follow am drag am too, so Isaak koll di well, Sitnah. 22 Den e komot from der kon go dig anoda well. Nobody follow am kworel for dis one, so Isaak kon koll am Rehobot dey sey, “Naw Oga God don make room for us and wi go prosper for dis land.”
23 From der, Isaak kon go Beersheba. 24 God appear to am dat nite kon sey, “Na mi bi yor papa Abraham God. Make yu nor fear, bikos I dey with yu. Bikos of my savant Abraham, I go bless yu kon make yor shidren-shidren plenty.” 25 Den Isaak build one altar for der kon woship God. E put en tent for der and en savant kon dig anoda well.
Isaak Agri With Abimelek
26 Naw, King Abimelek don kom visit am from Gerar with en friend Ahuzzat and Fikol wey bi di sojas oga. 27 Isaak kon ask dem, “Wetin make una kom meet mi? Nor bi bikos una hate mi, naim make una porshu mi?”
28 Dem ansa, “E klear sey God dey with yu. So wi kon sey, make peace dey between us: dat is between wi and yu. Make yu allow us make peace with yu, 29 so dat yu nor go ponish us, just as wi nor ponish yu, but wi dey always trit yu well, before wi even porshu yu with peace. Naw God don bless yu.”
30 So Isaak do party for dem kon celebrate. 31 Very early for di next morning, Isaak and King Abimelek kon make peace with each oda. Isaak kon escort dem and dem kon komot without wahala. 32 Dat day, Isaak savant kon tell Isaak about di well wey dem dig sey, “Wi don si wota.” 33 So Isaak koll di well Shibah; dat na why dem dey koll di town till today, Beersheba.
Esau And En Strenj Wifes
34 Wen Esau don rish forty years, e kon marry Judit wey bi Beeri pikin and Beeri kom from Hit. E still marry Basemat wey bi Elon wey Het pikin born. 35 Di matter nor kon make Isaak and Rebekah, happy.