25
Abraham Oda Shidren
Abraham kon marry anoda wife and di woman name na Keturah. Di woman kon born Zimran, Jokshan, Medan, Midian, Ishbak and Shuah. Jokshan kon bi Sheba and Dedan papa. Den di shidren wey Dedan born na Asshur, Letush and Leumm. Midian sons na Efah, Efer, Hanok, Abidan and Eldaah. All dis na Keturah shidren-shidren.
Evritin wey Abraham get, e gi-am to en pikin Isaak. But wen Abraham still dey alive, e give gift to di shidren wey en oda wifes born for am kon send dem go east, so dat dem go dey fast and nor disturb Isaak.
Abraham Die
Abraham stay for one hundred and seventy-five years. Den Abraham die for betta old age. E really old and live betta life. E die go join en grand-grand papa dem. En pikin Isaak and Ishmael kon beri am for Makpelah grave near Mamre, for Efron field and dis Efron na Zohar wey kom from Hit, pikin. 10 Dis na di field wey Abraham buy from Het shidren. So dem beri Abraham and en wife Sarah for der. 11 Afta Abraham don die, God kon bless en pikin Isaak. Isaak dey stay near Beer Lahai Roi.
Ishmael sons
12 Dis na di story about di pikin Ishmael wey Hagar di woman wey kom from Egypt; Sarah savant born give Abraham. 13 Dis na Ishmael pikin names akordin to as dem write am: Nebaiot (Ishmael first-born), Kedar, Adbeel, Mibsam, 14 Mishma, Dumah, Massa, 15 Hadad, Tema, Jetur, Nafish and Kedemah. 16 Dis na Ishmael pikin and dis na dia names for where dem stay and kamp put, bikos dem bi twelf prince, akordin to dia family. 17 Ishmael stay for 137 years. E die kon go join en grand-grand papa. 18 E shidren-shidren kon stay for Havilah go rish Shur wey pass Egypt go rish Asshur. Dem nor stay near dia relashon at-all.
Jakob And Esau
19 Dis na di story about Abraham pikin Isaak. Abraham na Isaak papa. 20 Wen Isaak na forty years, e kon marry Rebekah wey bi Betuel, di Aramean pikin and dis Betuel kom from Paddan Aram. Rebekah broda na Laban di Aramean. 21 Isaak pray to Oga God for en wife, bikos e neva born. God ansa en pray and en wife Rebekah kon get belle. 22 But di shidren kon dey struggol inside am, so di woman kon sey, “If na so e go bi, I nor sure sey I like get belle!”
So di woman ask God 23 and Oga God kon tell am, “Na two nashons dey yor belle and two pipol go kom out from inside yu. One go dey strong pass di oda one and di senior one, go serve di yonga one.”
24 Wen di time don rish for Rebekah to born, na two pikin dey en belle. 25 Di first one kom out, evriwhere for en body red and hair full am, so dem kon koll am Esau. 26 Wen en broda kom out, e hold Esau leg, so dem kon koll am Jakob. Isaak na sixty years wen Rebekah born dem.
Esau Sell En Birt-rite
27 Wen di boys don big, Esau kon sabi katch animals; e sabi di work well-well, but Jakob na kwayet man wey dey stay house. 28 Isaak love Esau, bikos e like fresh bush meat, but Rebekah love Jakob.
29 One day, Jakob kook some stew and wen Esau kom back from di bush, e kon dey hongry. 30 So Esau tell Jakob, “Make yu give mi some stew make I chop, bikos hongry dey kill mi!” (Dat na di resin why dem dey still koll am, Edom.)
31 But Jakob ansa, “Make yu first gri sey na mi bi senior.”
32 Esau kon sey, “Si, na die I dey so! Dis senior tin nor even dey yuzful to mi!”
33 But Jakob sey, “Make yu first swear about am.” So Esau swear kon give di senior pozishon to Jakob. 34 Den Jakob give Esau some bread and stew; Esau chop kon drink wota den e get up waka komot der. Na so Esau take sell en rite as senior give Jakob.