24
Isaak Wife
Abraham don old well-well and God don bless am for evritin. One day, Abraham tell en savant wey old pass, di one wey dey guide di house sey, “Make yu put yor hand under my lap. Den promise with di Oga God name, di God for heaven and eart sey yu nor go allow my pikin marry one for doz local Kanaan wimen. Instead, make yu go my village go meet my relashon kon find wife among dem for my pikin Isaak.”
Di savant ask, “But wetin I go do if di woman nor gri follow mi kom back to dis far land? Make I take yor pikin go back to di land wey yu from kom?”
Abraham ansa, “Make yu nor take my pikin go back to dat land! Oga wey bi di God for heaven wey take mi komot from my papa house and di land wey my pipol dey, naim promise mi wen E promise sey, ‘I go give dis land to yor shidren-shidren.’ So God go send en angel go for yor front, so dat yu go si one good wife for der kon bring kom give my pikin. But if di woman nor won follow yu kom back, dis swear nor go do yu anytin. But make yu nor take my pikin go back to dat land!”
So di savant put en hand under en oga Abraham lap kon promise sey e go do as Abraham tok. 10 Den di savant take ten kamel from en oga own kon go with difren gifts from en oga, just as e wont. E travel go Aram Naharaim aria for Nahor town. 11 E make di kamel knee down near di well wey dey outside di town. Dat na evening time wen di wimen dey kom fetch wota.
12 E kon pray, “My Oga God, wey bi my masta Abraham God, make Yu guide mi today. Make Yu dey good to my oga Abraham. 13 I stand near dis well and di pipol wey dey stay dis town, dia dotas go kom fetch wota. 14 I go tell one among dem sey, ‘Abeg make yu give mi wota drink.’ Den make di one wey Yu don choose for yor savant Isaak ansa, ‘Make yu drink and I go give yor kamel make dem drink too.’ Like dis, I go know sey Yu dey good to my oga.”
15 Before e pray finish, Rebekah kon dey kom with en wota pot for en shoulder. E bi Betuel pikin and en grand-mama na Milka (Milka na Abraham broda wife, Nahor). 16 Di girl fine well-well. E neva sleep with anybody for en life. Rebekah go di well, fetch wota put for en pot kon dey kom back. 17 Den Abraham savant run go meet am kon sey, “Abeg make yu give mi small wota drink from yor pot.”
18 Rebekah ansa, “My oga, make yu drink,” den di girl kwik-kwik karry en pot put for en hand kon gi-am wota drink. 19 Wen di girl don do like so, e kon sey, “I go fetch wota for yor kamel until dem don drink beleful too.” 20 So di girl kon pour all di wota wey dey en pot inside where di kamels go for drink, den e run go back go fetch more wota until all di kamel don drink beleful. 21 Di man just kwayet dey look am just to know if God don make en travel get head or not. 22 Afta di kamels don drink finish, di man bring one gold ring wey dem dey put for nose and two gold shain for waist kon gi-am to di girl.
23 Den e ask di girl, “Na wish pesin pikin yu bi?” Abeg make yu tell mi, “Yor papa go get any empty room for mi wey I fit sleep put dis nite?”
24 Rebekah ansa, “I bi Betuel pikin and na Milka and Nahor born Betuel. 25 Yes, wi get plenty food for yor kamel and wi get room for strenjas.”
26 Di savant kon bow for groun woship God. 27 E kon sey, “Make praiz bi God own, my oga Abraham God, bikos Yu don show mi yor love wey nor dey fail and as Yu dey good to my oga family.”
28 Di girl kon run go house go tell en family evritin wey happen. 29 Naw, Rebekah get one broda wey en name na Laban and e run go meet di man for di well. 30 Wen e si di shain for en sista hand and di ring for en nose kon hear wetin en sista tok wen e sey, “Dis na wetin di man tok”, e run go meet di man for where e for still stand near en kamels. Laban kon tell am, 31 “Make yu kom stay with us, bikos God don bless yu! Wetin make yu stand for outside di town wen I get room for yu and I go fit prepare somewhere for yor kamels?”
32 So di man follow Laban go house and Laban pak all di load komot di kamel back kon klean, feed and give di man and di kamel drivers wota make dem take wosh dia legs. 33 Wen dem serve food for dem, e kon sey, “I nor go chop until I don tok wetin I won tok.”
Laban ask am, “Wetin yu won tok.”
34 E kon sey, “I bi Abraham savant. 35 God don really bless my oga and e get evritin wey e wont. Oga God don gi-am sheep, kattle, gold, silva, man and woman savants, kamel and donkey. 36 My oga wife Sarah born only one pikin for am wen dem don old and my oga don give di pikin evritin wey e get. 37 My oga make mi swear wen e sey, ‘For here wey I dey stay, yu nor go marry any Kanaan woman give my pikin Isaak, 38 but make yu go my family house go find wife for my pikin.’
39 “But I tell my oga sey, ‘Wot of if di woman sey e nor go follow mi kom?’ 40 E kon ansa mi, ‘God wey I dey serve, go send en angel follow yu go. E go make yor journey well and yu go si wife for my pikin from among my papa family. 41 Yu go dey free from di swear if yu go meet my family and dem nor gri give di girl to yu. True-true, yu go dey free.’
42 “Wen I rish di well today, I kon pray sey, ‘My Oga wey bi my oga Abraham God, if Yu know sey Yu go make my journey well, make evritin happen as dem suppose bi.’ 43 As I stand near di well so. Wen di rite girl go kom fetch wota, I go tell am, ‘Make yu give mi wota from yor pot make I drink.’ 44 Den di girl go ansa, ‘Make yu drink and I go fetch give yor kamels too.’ Den na dat girl go bi di one wey di Oga God don choose for my oga pikin.
45 “Before I pray finish inside my heart, I kon si Rebekah dey kom fetch wota with en wota pot for en shoulder. So I tell am, ‘Make yu give mi wota drink.’ 46 E kon kwik-kwik put en pot down from en shoulder kon sey, ‘Make yu drink and I go give yor kamels wota too.’ So I drink and e kon give my kamel dem drink too. 47 Den I ask am, ‘Na wish pesin pikin yu bi?’ Di girl ansa, ‘I bi Betuel wey en papa na Nahor and na Milka born Betuel for Nabor.’ So, I kon put di ring for en nose and di shain for en hand.
48 “Den I bow woship God wey bi my oga Abraham God, bikos na-im lead mi for di korrect way, so dat I go meet my oga Abraham broda Nahor grand-pikin. 49 Naw, if una go show sey una dey good to my oga, make una tell mi. But if una nor gri, make una still tell mi too, so dat I go-go back.”
50 Den Laban and Betuel ansa, “Dis na as God wont am. Wetin wi wont nor mean anytin. 51 Na Rebekah stand so for yor front. Make yu take am dey go, so dat e go bi yor oga Abraham pikin wife, just as God don tok am.”
52 Wen Abraham savant hear wetin dem tok, e bow face groun kon woship God. 53 Den e bring gold, silva, klot and oda tins kon give dem to Rebekah. E still give some betta gifts to Rebekah broda and mama. 54 Afta, en and di men wey dey with am kon chop and dem stay der dat nite till day break. Wen dem wake-up di next morning, Abraham savant kon sey, “Make I dey go naw go meet my oga.”
55 But Rebekah broda and mama kon ansa, “Make di girl still stay with us for like ten days, den e fit kom meet una.”
56 But di savant tell dem, “Make una nor keep mi, God don make my journey get head. Make una let mi go meet my oga naw.”
57 Den dem sey, “Make wi hear from di girl mout.” 58 So dem koll Rebekah kon ask am, “Yu wont follow dis man go?”
E ansa, “Yes! I go follow am.”
59 So dem kon give dia sista Rebekah to di man, but some savant follow am, with Abraham savant and en men. 60 Dem bless Rebekah kon sey:
“Awa sista, yu go bi
mama to tazon-tazon pipol!
Yor shidren-shidren pawa go strong
pass dia enemies own.”
61 Den Rebekah and en wimen savant klimb di kamel kon follow Abraham savant. So Abraham savant take Rebekah go.
62 Naw, Isaak kom from Beer Lahai Roi, bikos e dey stay for Negev. 63 As evening dey rish, Isaak kon go di field go relax. Den e look kon si sey some kamel dey kom. 64 Wen Rebekah look, e kon si Isaak. E kom down from en kamel 65 kon ask Abraham savant, “Na who bi dat man for di field wey dey waka kom meet us?”
Di savant ansa, “Na my oga bi dat.” So di girl take en klot kon kover ensef well. 66 Di savant tell Isaak evritin wey happen.
67 Den Isaak take Rebekah enter en mama room. E take am as en wife kon love am. So, Rebekah make Isaak mind rest, afta en mama don die.