27
Jakob Kollect Esau Blessing
Wen Isaak don old well-well and e nor dey si well again, e koll en senior pikin Esau kon tell am, “My pikin!”
Esau ansa, “Papa, na mi bi dis!”
Isaak tell am, “Since I don old, I fit die anytime. So make yu take yor weapons go katch animal kom for mi. Make yu prepare betta food for mi, di kind one wey yu know sey I love, den bring am kom meet mi. Den I go chop kon bless yu before I die.”
As Isaak dey tok to Esau, Rebekah dey one korna dey listin. Wen Esau don go katch di animal, Rebekah kon tell en pikin Jakob, “Si, I hear wen yor papa dey tell yor broda Esau sey, ‘Make yu go katch animal for mi kon kook dem make I chop, den I go bless yu for Oga God present, before I go die.’ Naw, my pikin, make yu do as I tell yu! Go where di animals dey kon kill one of di goats. I go prepare dem make e sweet well-well as yor papa dey like am. 10 Den yu go take am go give yor papa. E go chop am kon bless yu before e die.”
11 But Jakob kon tell en mama, “My broda Esau get hair full body and my skin smooth! 12 My papa fit tosh mi! Den e go tink sey I dey fool am and e go curse mi instead of am to bless mi.”
13 So en mama tell am, “My Pikin! Any curse wey dem curse yu, I go use my head karry am! Make yu just obey mi! Just go get dem for mi!”
14 So Jakob take di goat go give en mama. Di woman kon kook some sweet food, just as Isaak dey like am. 15 Den Rebekah take en senior pikin, Esau best klot wey e get for house kon wear am for Jakob. 16 E put di goat skin for en hand and di part wey smooth for en neck. 17 Den di woman karry di food wey e make, give Jakob. 18 Jakob go meet en papa kon sey, “My papa!”
Isaak ansa, “Na mi bi dis. Wish of my pikin dey tok?”
19 Jakob ansa en papa, “Na mi Esau, yor first pikin. I don do as yu tell mi. Naw sidan make yu chop, so dat yu go bless mi.”
20 But Isaak ask en pikin, “Na how yu take kill di animal just naw just naw?”
Jakob ansa, “Na di Oga yor God help mi.”
21 Den Isaak tell Jakob, “My pikin, make yu kom near mi, so dat I go fit tosh yu kon know if yu really bi Esau.” 22 So Jakob waka go near en papa Isaak and Isaak tosh am kon sey, “Di vois bi like Jakob own, but di hand bi like Esau own.” 23 E nor know Jakob bikos hair full en hand like en broda Esau own. So Isaak bless Jakob. 24 Den e ask am, “Yu sure sey na yu bi Esau?”
Jakob ansa, “Na mi na!”
25 Isaak kon tell am, “My pikin, make yu bring some for di bush meat make I chop. Den I go bless yu wen I chop finish.” So Jakob take some for di bush meat go give en papa and Isaak chop am. E still gi-am wine drink too. 26 Den en papa Isaak kon tell am, “My pikin, make yu kom here kon kiss mi.”
27 So Jakob waka go kiss am. Wen Isaak feel as en klot dey smell, e kon bless am sey,
“Yes, my pikin dey smell
like sey e dey inside bush
wey God don bless.
28 Make God give yu di dew from di sky
and di good tins wey dey di eart,
plus many korn and wine.
29 Pipol go serve yu
and nashons go bow to yu.
Na yu go bi oga ova yor broda
and yor mama shidren go bow for yu.
Anybody wey curse yu, curse go dey en head
and blessing go follow doz wey bless yu.”
Esau Beg En Papa
30 As Isaak just bless Jakob finish and as Jakob dey waka leave am, en broda Esau just dey kom back. 31 Esau too prepare sweet food won go give en papa. Esau kon tell en papa. “My papa, get up make yu chop some bush meat wey yor pikin kook, so dat yu go bless mi.”
32 En papa Isaak ask am, “Na who yu bi?”
Esau ansa, “Na mi bi yor first-born, Esau!”
33 Isaak kon dey shake well-well, so e ask, “Den na who kon give mi bush meat chop? I chop evritin before yu kom and I bless di pesin. And blessing go really follow am!”
34 Wen Esau hear wetin e papa tok, e shaut kon dey kry well-well. E kon tell en papa, “Papa, make yu bless mi too!”
35 But Isaak ansa, “Yor broda Jakob don kon deceive mi kollect yor blessings.”
36 Esau still sey, “En name really na Jakob! E don kollect two tins for my hand naw! E first kollect my rite as senior and naw si, e don take my blessing!” Den e ask en papa, “Yu nor keep any blessing for mi?”
37 Isaak ansa, “Si! I don make am oga ova yu. I don make evribody wey rilate to am to bi en savant kon bless am with many korn and wine. Wetin dey naw wey I go fit do for yu, my pikin?”
38 Esau kon tell en papa, “My Papa, so yu nor get only one blessing for mi? Abeg make yu bless mi too!” Den Esau kon dey kry well-well.
39 So en papa Isaak kon tell am,
“True-true, where yu dey
nor go get di good wey di land dey give
and di dew for di sky nor go fall for yor place.
40 Na so-so swod yu go take dey fight
and yu go serve yor broda.
But wen e don taya yu,
den yu go free yorsef from all dis tins.”
41 So Esau kon hate Jakob, bikos of en blessing wey en papa give en broda. Esau kon tell ensef sey, “Di time to mourn for my papa don near, den I go kill my broda Jakob!”
42 Wen Rebekah hear wetin en senior pikin, Esau tok, e koll en yonga pikin Jakob kon tell am, “Si, yor broda Esau dey try to revensh, so e don sey e go kill yu. 43 Naw, my pikin make yu do wetin I tok. Run naw-naw go meet my broda, Laban for Haran. 44 Make yu stay with am small, until yor broda Esau nor dey vex for yu again. 45 Make yu stay der until Esau nor dey vex and e don forget evritin wey yu do am. Den I go send pesin make dem bring yu kom back. I nor fit luz di two of una for di same day.”
Jakob Go Meet Laban
46 Den Rebekah tell Isaak, “I nor dey happy bikos of dis Het dotas. E betta make I die, instead of Jakob to marry one among dis Het dotas wey dey dis land!”