6
Darius Kommand
So King Darius kon orda sey make dem go search di royal rekord wey dem keep for Babilon. But na for Ekbatana town for Media aria naim dem for si one book wey get dis rekord:
For di first year wen King Cyrus dey rule, e kommand sey make dem ribuild di temple for Jerusalem as di place where dem for go dey offa sakrifice and burnt ofrin.
E sey, make di temple high and wide rish ninty-nine fit. Make dem build di wall with one layer and make wood dey on-top each layer. Na di pesin wey dey keep di royal money, go pay for evritin. Make dem still riton all di gold and silva tins wey King Nebukadnezzar karry from di temple for Jerusalem kom Babilon. Make dem put dem for God temple, di place where dem dey before.
King Darius Ansa
Den King Darius ansa:
To Tattenai, di govnor for West Eufrates, Shetar-Bozenai and una ofisas for der, make una nor go near di temple and nor tok as dem dey build am. Make una allow di govnor for Judah and di leaders ribuild God Temple as e bi before.
I kommand una naw sey, make una help dem ribuild di temple.
Di palis go use di tax wey dem kollect from West Eufrates take pay for evritin, so dat nor-tin go stop di work. Una must give di priest for Jerusalem anytin wey dem tell una sey dem wont: yong melu, sheep or lamb wey dem go burn as ofrin give di Oga God wey dey heaven or even if na wheat, salt, wine or olive oil dem nid for dia ofrin. 10 Una must give dem dis tins, so dat dem go fit offa sakrifice wey God wey dey heaven go asept and pray make E bless mi and my sons.
11 So, I kommand sey if any of una nor obey dis orda, dem go komot one wood pila from en house, sharp one side, den take am shuk di pesin die. And dem go turn di house to where dem dey trowey dirty put. 12 Make di God wey choose Jerusalem as di place where dem go for woship am ova-trow any king or nashon wey nor obey dis kommand or won try distroy di temple.
Mi, Darius don kommand and una must obey my kommand go rish di end.
13 Den govnor Tattenai, Shetar-Bozenai and dia ofisas kon do evritin wey di king kommand. 14 Jew leaders kon dey progress well-well as dem dey build di temple, wey profet Haggai and Zekaraya enkourage dem to build. Dem komplete di temple, just as Israel God, King Cyrus, King Darius and King Atazazes for Persia kommand sey make dem do. 15 Dem finish di temple for di third day for Adar mont (First mont) for di sixt year wen King Darius dey rule.
16 Den Israel pipol, di priests, Levi pipol and all di oda pipol wey kom back from Babilon kon dedikate di temple with joy. 17 For di dedikashon, dem offa 100 melu, 200 sheep and 400 lamb as sakrifice and 12 goat as ofrin for sin, one for each tribe for Israel. 18 Dem still arrange di priests and Levi pipol wey go dey serve for di temple for Jerusalem, just as dem rite am for Moses Law.
19 Di pipol wey kom back from Babilon celebrate Passova for di fourteent day for di first mont. 20 All di priest and Levi pipol kon santify demsef. Levi pipol kill di animals wey dem use for di Passova sakrifice for evribody wey kom back from Babilon; for di priests and for demsef. 21 Den Israel pipol wey kom back, chop di sakrifice with doz wey don stop to serve di juju wey di pipol wey dey di land before, dey serve. All of dem kon woship di Oga wey bi Israel God. 22 Dem happy well-well as dem dey celebrate di Bread wey nor get Yist Feast, for seven days. Belle sweet dem well-well, bikos God shange Assyria king karata and e kon support dem as dem dey ribuild Israel God Temple.