7
Ezra Kom Jerusalem
Afta all dis tins don happen, for di time wen King Atazazes dey rule Persia, one man wey en name na Ezra kon kom from Babilon. E trace en grand-grand papa family kon know sey e kom from Aaron, di High Priest family. Ezra na Seraya pikin and na Zabud wey Hilkaya born, bi Seraya papa. Na Shallum born Hilkaya. Zadok wey Ahitub born, na-im bi Shallum papa. Na Amaraya born Ahitub and na Zabud bi Amaraya papa. Na Meraiot born Zabud. Zerahaya wey bi Uzzi pikin, na-im bi Meraiot papa. Bukki born Uzzi, and na Abishua wey Finehas born bi Bukki papa. Eleazar wey bi Aaron pikin, na-im bi Finehas papa. Ezra go skool and e know di law wey di Oga wey bi Israel God give Moses, well-well. Bikos God dey with Ezra, di king dey gi-am evritin wey e ask for. For di sevent year wey Atazazes dey rule, Ezra komot from Babilon go Jerusalem with some Israel pipol and some among dem na priests, Levi pipol, doz wey dey sing for di temple, temple guards and workers.
Dem komot from Babilon for di first day for di first mont and with God help, dem rish Jerusalem for di first day for di fift mont. 10 Ezra main work na to dey study God law, pratise am and tish Israel pipol how to obey God.
King Atazazes And Ezra
11 King Atazazes give dis leta to Ezra wey bi priest, wey sabi read and know evritin about di law and kommand wey God give Israel pipol:
12 From Atazazes wey bi king of all kings to Priest Ezra wey know God for heaven law well-well: I greet yu.
13 I dey kommand sey for evriwhere for my kingdom, make Israel pipol, priests, Levi pipol and doz wey like to go, follow yu go Jerusalem. 14 Mi and my seven advisers dey send yu go shek wetin dey happen for Jerusalem and Judah and to si weda dem dey obey yor Oga God law wey dey yor hand. 15 Yu go take di gold and silva ofrin follow body, bikos na mi and my seven advisers won gi-am to Israel God, wey en temple dey Jerusalem. 16 Make yu still take all di gold and silva wey yu fit kollect from Babilon and di ofrin wey Israel pipol and dia priests give for dia Oga God Temple for Jerusalem. 17 Yu must spend di money well kon buy bulls, rams, lamb, korn and wine, den make yu offa dem for di altar for di temple wey dey Jerusalem.
18 Yu fit use di silva and gold wey remain take do wetin yu and yor kountry-men like, so-far na as God wont am. 19 Make yu show yor pipol evritin wey wi give yu, so dat dem go gi-am to God for di temple for Jerusalem. 20 Yu fit still kollect anytin wey yu wont for di temple from di palis propaty.
21 I kommand sey make all di ofisas wey dey keep money for West Eufrates aria provide for Priest Ezra wey know God for heaven law. Make una give dem 22 7,500 silva pound, 100 bags for wheat, 100 gallon for wine, 100 gallons for olive oil and plenty salt. 23 Yu must do evritin wey God for heaven wont for en temple kon make sure sey, E nor ever vex for mi and doz wey go rule afta mi. 24 Nor kollect any tax from di priests, Levi pipol, muzicians, guards or doz wey dey work for di temple.
25 As for yu Ezra, make yu use di wisdom wey yor God give yu, take choose ofisas and judge wey dey obey God and na dem go rule di pipol for West Eufrates. Yu must tish evribody wey nor know di law. 26 Make dem ponish anybody wey nor obey yor God law or di law for di kingdom: dem go kill or porshu di pesin komot from di town. Dem fit seize en propaty or put am for prison.
27 Ezra kon sey, Make wi praiz di Oga, wey bi awa grand-grand papa dem God! Na-im make di king honor God Temple for Jerusalem like dis. 28 E still don let mi get favor from di king, en advisers and en ofisas wey get pawa well-well. Di Oga my God don give mi strent so I gada leaders among Israel pipol for Babilon wey go follow mi go back to Jerusalem.