5
Temple Work
Dat time, two profet wey dia name bi Haggai and Zekaraya wey Iddo born kon start to prish with Israel God name give Jew pipol wey dey stay for Judah and Jerusalem. Wen Zerubabel, Shealtiel pikin and Jeshua wey Jozadak born hear dia message, dem kon start to ribuild di temple for Jerusalem and di two profet help dem.
At wons, govnor Tattenai for West Eufrates, Shetar-Bozenai and dia ofisas kom Jerusalem kon ask: Who orda una sey make una start to ribuild dis temple and komplete am? Dem still ask, Di pipol wey help una dey ribuild dis temple so, wetin bi dia names? But God dey with Jew leaders, so Persia leaders nor kon do anytin until dem rite go give King Darius kon hear wetin e go tok.
Dis na di ripot wey dem send go give di king:
“To King Darius, make peace dey yor kingdom.
Awa oga, wi wont make yu know sey wi go Judah aria kon si sey dem dey build di great God Temple with big-big block kon use iron wood take do pilas for di wall. Dem dey do di work with kare and e dey go well.
So wi ask dia leaders sey, Who orda una make una ribuild di temple and komplete am? 10 Wi still ask for names, so dat wi go fit tell yu di pipol wey dey lead dem do di work.
11 But dem ansa,
Wi bi God for heaven and eart savants and wi dey ribuild di temple wey one pawaful king for Israel build before. 12 But bikos awa grand-grand papa dem make God for heaven vex, E kon allow King Nebukadnezzar for Babilon, wey dey rule Kaldean kingdom, attack and distroy di temple kon karry di pipol go Babilon as prisonas.
13 Den for di first year wen King Cyrus dey rule for Babilon, e kon orda sey make wi go ribuild di temple. 14 E riton di gold and silva tins (wey Nebukadnezzar take from di temple for Jerusalem go put for en own temple for Babilon).
King Cyrus riton di tins give one man wey dem dey koll Sheshbazzar, wey e choose as govnor for Judah. 15 Di king sey make e put di tins back for di temple for Jerusalem and ribuild di temple for where e bin dey. 16 So Sheshbazzar kon lay di foundashon and na since den wi don dey ribuild, but wi neva fit finish am.
17 Naw, awa oga, if yu like, make yu orda for di royal rekord for Babilon weda yu go si if King Cyrus really give orda sey make dem ribuild di temple for Jerusalem and den, make yu tell us wetin yu si for dis matter.”