4
Judah Enemies
Wen Judah and Benjamin enemies hear sey doz wey kom back from Babilon, dey ribuild di Oga wey bi Israel God Temple, dem go meet Zerubabel and di leaders kon tell dem, “Make una allow us join una ribuild di temple. Bikos wi dey woship di same God wey una dey woship and wi dey offa sakrifice to am ever since King Esarhaddon for Assyria send us kon stay here.”
Den Zerubabel, Jeshua and di leaders kon tell dem, “Wi nor nid una help to ribuild di Oga awa God Temple. Wi go build am by awasef, just as King Cyrus for Persia sey make wi do.”
Den di pipol wey dey stay di land before won kon try to diskorage and put fear for Judah pipol mind, so dat dem nor go build di temple. Dem still go bribe Persia ofisas, so dat dem go attack Judah pipol. Dem kontinue to dey do like dis thru-out di time wey Cyrus dey rule and dem do am enter King Darius time.
Dem Komplain Against Judah
Wen King Zazes start to rule, Judah enemies wey dey stay for Judah and Jerusalem kon go komplain against dem.
And wen King Atazazes dey rule for Persia, Bishlam, Mitredat, Tabeel and some pipol wey dey follow dem, rite leta go give di king. Dem rite di leta for Aramaik language, but dem go tok di meaning wen dem dey read am.
Rehum too wey bi di govnor and Shimshai, di aria seketry kon rite dis leta about Jerusalem go give King Atazazes sey:
“From Rehum wey bi di govnor and Shimshai di aria seketry; from di judge dem and all di ofisas from Erech, Babilon and Shushan wey dey Elam land, 10 with di pipol wey di great and pawaful Ashurbanipal karry from dia town go stay Samaria and West Eufrates aria.
11 “(Dis na wetin dem rite for di leta)
To King Atazazes and from en savants, di pipol for West Eufrates.
12 Wi wont make di king know sey Jew pipol wey kom from yor oda aria, don dey stay for Jerusalem and dem dey build dat evil and yeye town back. Dem don start to build di wall and go soon finish am.
13 Awa oga, if dem build dis town back kon komplete di wall, di pipol go stop to pay tax and di money wey yu dey get for di palis bag, nor go rish again. 14 Naw, bikos of di way wi dey loyal to yu, wi nor won si sey anybody disrespet di king, so wi dey sugest sey, 15 make yu orda make dem search for di rekord wey yor grand-grand papa keep. If yu do am, yu go si sey, before-before, di town too like wahala and e don give kings, kingdoms and rulers, many trobol. Di pipol for der, dey hard to rule and na dis make dem distroy di town. 16 So wi bilive sey, if dem build di town back kon komplete di wall, awa oga nor go fit kontrol West Eufrates aria again.”
17 Di King kon ansa dem:
“To Rehum di govnor; Shimshai di aria seketry; doz wey dey stay Samaria and di remain part for West Eufrates: I dey greet una.
18 Dem don translate and read di leta wey una send kon give mi and 19 I don orda sey make dem find out and dem sey, na true sey Jerusalem dey go against royal authority before; na so-so trobol dem dey find and pipol wey nor dey obey di law, full der. 20 Kings wey get pawa don rule for der before and dem rule di whole West Eufrates aria, dey kollect tax and oda money. 21 So, make una stop to ribuild di town until I kommand make dem build am again. 22 Naw, make una go do wetin I tok, so dat my kingdom go get peace.”
23 As soon as dem just read di leta wey King Atazazes send go give Rehum, Shimshai and di pipol, dem kon rush go Jerusalem go force and stop Jew pipol to ribuild di town.
24 So dem stop to build di temple until di sekond year wen King Darius dey rule for Persia.