3
Di Pipol Start To Woship
For di sevent mont wey Israel pipol don dey stay for dia towns, all of dem kon gada for Jerusalem and Jeshua wey Jehozadak born, en fellow priests, Zerubabel wey bi Shealtiel pikin and en family membas kon build di Oga wey bi Israel God altar back, so dat dem go fit dey burn sakrifice for der akordin to wetin dem rite for God savant, Moses Law. Even doh di pipol wey kom back from Babilon dey fear doz wey dey di land, dem still build di altar put for where e dey before. So dem start to burn di normal morning and evening sakrifice for der. Dem celebrate Shelta Festival akordin to wetin dey di law and evriday, dem dey offa di sakrifice wey dem suppose offa with di regular sakrifice, both for di New Moon Festival and di oda feast to take woship God. Di pipol dey still give ofrin to God from dia mind. Aldo di pipol neva start to ribuild di temple, but dem start to burn sakrifice give God for di first day for di sevent mont.
Dem Ribuild Di Temple
So di pipol give money to take pay doz wey dey mold block with di karpenters. Dem send food, drink and olive oil go Tyre and Sidon, so dat dem go give dem cedar trees from Lebanon. Dem karry di trees pass Joppa wotaside and na King Cyrus for Persia allow dem do all dis tins.
So dem start work for di sekond mont for di year afta dem kom back to Jerusalem where di temple dey. Zerubabel wey Shealtiel born, Jeshua wey Jozadak born, plus all di pipol, di priests and Levi pipol wey kom back from Babilon kon join do di work. Dem put Levi pipol wey don rish twenty years or wey don old pass dat age small make dem dey supavise di work. Jeshua wey kom from Levi tribe, en sons and family membas, Kadmiel and en sons (wey bi Hodevah family) join ribuild di temple. (Henadad family wey bi Levi pipol, help dem too.)
10 Wen di men start di temple foundashon, di priests wear dia garment, stand for dia pozishon kon hold dia trumpet for hand. Levi pipol wey kom from Asaf family still stand der too with dia cymbals. Dem praiz God akordin to wetin dem rite down for King David time. 11 Dem sing praiz God sey:
God dey good
and en love for Israel
nor dey end.
Evribody kon bigin shaut praiz God with all dia pawa, bikos dem don start work for di temple. 12 Many of di priests, Levi pipol and di head for each family wey bin si di first temple kon dey kry well-well as dem start to ribuild di temple. But di odas dey happy. 13 Nobody know who dey happy or kry, bikos di nois wey dem dey make, loud well-well and dem dey hear am from far.