2
Doz Wey Go Back
Dis na di pipol wey from Babilon go back to Jerusalem and Judah. And each of dem go back to en town. Dia family dey Babilon since King Nebukadnezzar take dem go der as prisonas. Dia leaders na Zerubabel, Jeshua, Nehemaya, Seraya, Reelaya, Mordekai, Bilshan, Mispar, Bigvai, Rehum and Baanah. Dis na di list and di nomba of pipol from each family for Israel wey kom back from Babilon:
Parosh family na 2,172, Shefataya family na 372,
Arah family na 775, Pahat-Moab (Jeshua and Joab shidren-shidren) na 2,812,
Elam family na 1,254, Zattu family na 945,
Zakkai family na 760, 10 Bani family na 642,
11 Bebai family na 623, 12 Azgad family na 1,222,
13 Adonikam family na 666, 14 Bigvai family na 2,056,
15 Adin family na 454, 16 Ater (wey kom from Hezekaya family), en family na 98,
17 Bezai family na 323, 18 Jorah family na 112,
19 Hashum family na 223, 20 Gibbar family na 95.
21 Betlehem men na 123, 22 Netofat men na 56,
23 Anatot men na 128, 24 Azmavet men na 42,
25 Kiriat-Jearim, Kefirah and Beerot men na 743, 26 Rama and Gibeah men na 621, 27 Mikmash men na 122,
28 Bethel and Ai men na 223, 29 Nebo family na 52, 30 Magbish family na 156, 31 Di oda family for Elam na 1,254,
32 Harim family na 320, 33 Lod, Hadid and Ono men na 725,
34 Jeriko men na 345, 35 Hassenaah family na 3,630.
36 Dis na di list of di priests family wey kom back from Babilon:
Jedaya (wey bi Jeshua shidren-shidren) and dem bi 973,
37 Imma family na 1,052, 38 Pashhur family na 1,247,
39 Harim family na 1,017.
40 Levi family wey kom back from Babilon na: Jeshua and Kadmiel (wey bi Hodevah shidren-shidren) na 74.
41 Di temple muzicians (wey bi Asaf shidren-shidren) na 128.
42 Di temple guards (wey bi Shallum, Ater, Talmon, Akkub, Hatita and Shobai shidren-shidren) na 139.
43 Di pipol wey dey work for di temple, wey kom back from Babilon, dia family na: Ziha, Hasufa, Tabbaot, 44 Keros, Siaha, Padon, 45 Lebanah, Hagabah, Akkub, 46 Hagab, Shamlai, Hanan, 47 Giddel, Gahar, Reaaya, 48 Rezin, Nekoda, Gazzam, 49 Uzza, Paseah, Besai, 50 Asnah, Meunim, Nefusim, 51 Bakbuk, Hakufa, Harhur, 52 Bazlut, Mehida, Harsha, 53 Barkos, Sisera, Temah 54 Nezaya and Hatifa.
55 Solomon savants families wey kom back from Babilon na: Sotaya, Hassoferet, Peruda, 56 Jaalah, Darkon, Giddel, 57 Shefataya, Hattil, Pocheret-Hazrebaim and Ami.
58 All di pipol wey dey work for di temple and Solomon savant shidren-shidren wey kom back, na 392.
59 Dis na di ones wey kom from Tel-Melah, Tel-Harsha, Kerub, Addon and Imma (aldo dem nor fit show weda dem really kom from Israel tribe), di family na: 60 Delaaya, Tobaya and Nekoda shidren-shidren and dem bi 652.
61 Dis na some among di priests family wey dem nor fit show sey dem bi Israel pipol: Hobaaya, Hakkoz, Barzillai (wey marry one of Barzillai dotas, wey bi Gilead pesin and e kon dey ansa en fada-in-law name.)
62 Since dem nor fit prove who dia grand-grand papa bi, dem nor kon asept dem as priest. 63 So di govnor tell dem sey dem nor go fit chop di food wey dem offa give God, until di land don get priest wey go use Urim and Tummim.
64 Di total pipol wey kom back from Babilon na 42,360. 65 Even doh dem nor kount di men and wimen savant, dem still bi 7,337 wey kom back. Di men and wimen muzicians na 200. 66 Horse na 736, melu na 245, 67 Kamels na 435 and donkey na 6,720.
68 Wen di pipol rish God Temple for Jerusalem, some among di leaders for each family drop ofrin from dia mind make dem join am take ribuild God Temple for Jerusalem. 69 Dem give di amount wey dem fit give for di work and di total na: 61,000 pounds for gold, 5,000 pounds for silva and 100 garment for di priests.
70 Di priests, Levi pipol and some of di pipol, di singas, di temple guards and di temple workers stay for di town wey dey near Jerusalem; while di remainin Israel pipol stay for di towns wey dia grand-grand papa stay before.