7
Daniel Si Vishon
Di first year wen Belshazzar bi king for Babilon, Daniel dream one kind dream kon si plenty vishon wen e dey sleep, so e rite di dreams for book. Daniel sey: “As I dey dream dat nite, I kon si breeze dey blow from di four korna for di eart and di sea dey make strong nois. Den four big beast kom out from di sea and dem dey difren from each oda.
“Di first one bi like lion wey get eagle feada. As I dey look am, dem remove di feadas kon karry am komot groun. Dem make am stand with two leg like human being kon gi-am human being mind.
“Di sekond beast bi like bear. Dem karry am for one side. E get three rib for en mout and dem dey en tit centre. So I hear wen one vois tell am, ‘Get up make yu go chop pipol until yu beleful.’
“Afta all dis tins, as I dey look, anoda beast wey bi like leopard kon kom out with four feada for en back, di feada bi like bird own. Dis beast get four head and dem kom gi-am pawa to rule.
“As I still dey look for di vishon, di nomba four beast kom out: E get pawa, e wall-wall and pipol dey fear am well-well. En tit dem na iron. E dey distroy and skata anytin kon use en leg take skata wetin remain. E dey difren from all di beast wey first kom and e get ten horn.
“As I still dey look di horn, I si anoda small horn dey kom out from di big wons and three of di former horn kom skata make dis ones for fit kom out. Dis horn get eye wey bi like human being own and mout wey e take dey tok anyhow.
“As I still dey look, dem kom set throne and Oga God wey nor dey die kon sidan put. En klot dey white like snow and en hair bi like lamb skin. En throne dey bring fire like sey di wheel dey burn. 10 River with fire dey kom out from di throne. Pipol wey dey woship am, many well-well. Many-many pipol still dey wait to kom woship am. Den dem open di book, bikos dem won start to judge kase.
11 “I still dey look as di horn dey tok wiked-wiked words. I dey look until dem kill di beast kon distroy en body, den trow am inside di fire wey dey kom out from di throne. 12 Dem take di remainin beast pawas, but dem sey make doz beast still dey live for sometaim. 13 As I still dey look for di vishon for nite, I si wetin bi like human being. E dey waka kom with kloud wey dey round am, den e go show ensef give di Pesin wey dey live forever. 14 Dem gi-am authority, honor and pawa to rule. Evribody, nashon and pipol from difren tribe, go serve am. En pawa go last forever and nobody go fit distroy en kingdom.
Wetin Di Vishon Mean
15 “Di vishon wey I si dey disturb mi. 16 So I go meet one of dem wey stand for der kon tell am make e tell mi wetin e mean. Den e tell mi di meaning. 17 E sey, ‘Di four big beast na four kingdom wey go soon kom di eart. 18 And di pipol wey dey serve di Most High God go get royal pawa wey go dey forever and ever.’
19 “Den, I won kon know more about di nomba four beast wey nor bi like any of di oda beast; di beast wey dey make pesin fear; wey dey kill and skata wetin e fit skata with en bronze finger and iron tit. 20 I still won know about di ten horns for en head; di horns wey grow kom out leta; di three horns wey fall wey get eye and mout wey dey tok anyhow and en face dey make pesin fear pass any of di oda beast dem own. 21 As I still dey look, di horn kon dey fight and distroy God pipol, 22 until God wey dey live forever kon judge and favor all en holy shidren. Den di time kom rish for God to take-ova di kingdom.
23 “Dis na wetin e tell mi: ‘Di nomba four beast mean sey di eart go get four kingdom wey go difren from all di kingdoms wey dey before. Dem go skata and distroy di eart.
24 “ ‘Di ten horns mean di ten kings wey go kom from dat kingdom. Anoda king go kom afta dem, but e go dey difren from all di former kings. E go ova-trow three kings. 25 E go tok against God kon opress anybody wey dey serve God. E go try to shange laws, festivals and di pipol wey dey serve God, go dey under am for three and half years.
26 “ ‘But di kourt for heaven go sidan judge am kon take en pawa komot for en hand, den dem go distroy am finish. 27 Di pawa and great tins wey di world get, God kom gi-am to pipol wey dey serve am. Dia royal pawa nor go ever end and rulers go serve and respet dem.’
28 “Na like dis di matter take end. But for mi, Daniel, my mind kon dey disturb mi well-well and I kon kover my face bikos I dey fear. But I still keep evritin to mysef.”