8
Daniel Si Ram And Goat For Vishon
For di third year wey King Belshazzar dey rule, mi Daniel si anoda vishon apart from di ones wey I don si before. For dis vishon, I si mysef for Shushan wey dey Elam aria. As I stand near Ulai river, I look up kon si one ram wey get two horn and e stand near di river. Di two horn long, but one long pass di oda one. Di one wey long pass, kom out afta di short one. I si di ram dey waka with en horn dey go west, nort and sout-side. No animal fit stop am or eskape from en pawa. E dey do wetin e like and dey bihave anyhow.
As I still dey tink, one man goat kon dey kom from west side. E dey run fast-fast like sey en leg nor dey tosh groun. E get one horn between en two eyes. E rush kon attack di ram wey I si before, wey stand near di river. I dey look as e vex kon attack di ram, den e break di ram two horns and di ram nor get pawa to fight am back. Di goat trow di ram for groun kon dey mash am and nobody fit save am. Di goat kon dey strong more-more, but leta, en horns kon break. Den four horns kon grow kom out from where di two horns for break and each of di horns face difren direcshon.
From one of di horn, anoda small horn kon grow kom out. E grow big well-well kon face sout, east and di promise land. 10 E strong rish to attack God sojas for heaven; e even remove and trow some stars for groun kon stand on-top dem. 11 E still dey praiz ensef pass di sojas for heaven. E stop di sakrifice wey dem dey offa give God evriday kon skata where dem for dey woship God. 12 Instead of di normal sakrifice wey di pipol dey offa, dem kon start to sin, so dem forget God ways. Di horn dey enjoy evritin wey e dey do.
13 Den I hear one angel dey ask anoda one sey, “How long dis tin wey dey happen for dis vishon go kontinue? Dis wiked tin wey dem dey do go replace di sakrifice wey dem dey do evriday? How long di sojas wey dey heaven and di temple go dey under en leg?” 14 I kom hear di oda angel sey, “Na 2,000 three hundred days, both for morning and evening and for dat time, dem nor go offa any sakrifice.”
Anoda Angel Tok With Daniel
15 As I still dey try to undastand wetin di vishon mean, I kon si pesin stand for my front. 16 Den I hear vois from Ulai river dey sey, “Gabriel, make yu tell am di meaning of wetin e si.” 17 Gabriel stand near mi, so bikos I dey fear, I kon fall face groun. Naim e sey, “Man pikin, make yu undastand wetin e mean. Di vishon dey show yu how di world go take end.” 18 As e dey tok to mi, I kon faint for groun. But e tosh mi and I get up.
19 So e sey, “I kom tell yu wetin go happen wen trobol go dey for di world. Dis vishon na about wen di world won end. 20 Di ram wey yu si wey get two horn, na di two kings for Mede and Persia. 21 Di man goat na Greece king and di big horn wey dey between en eyes, na di first king. 22 Di horn wey break wey four oda horns kon grow kom out for en place, na di four oda kingdoms wey go kom from en nashon, but dem nor go get pawa like am. 23 Wen dia kingdom don dey won end and dia sin don plenty well-well, anoda wiked king wey sturbon and dey lie well-well, go kom ponish dem. 24 E go dey strong, but nor bi by en own pawa. E go kause strong wahala kon prosper for evritin wey e dey do. E go distroy doz wey get pawa and pipol wey dey serve God. 25 With en wayo, e go prosper as e dey lie and deceive pipol. E go dey bihave anyhow kon distroy many pipol without sey e first warn dem. E go fight and win kings wey get strong pawa, but e go skata wen nobody tosh or fight am. 26 Di vishon about morning and evening wey dem tell yu, korrect. But make yu keep di vishon for yor mind, bikos di time wey e go happen, neva rish.”
27 So I faint and I kon dey sick for some days. Den afta, I get up kon go do di work wey di king sey make I do. But di vishon still dey sopraiz mi, bikos I nor fit undastand wetin e mean.