6
Daniel Inside Lion Pit
Darius choose one hundred and twenty govnors wey go kare for di whole kingdom. Den di king choose three pesin wey go dey shek wetin di govnors dey do and Daniel dey among di three wey dey make di govnors do wetin di king wont. Naw as e bi, di work wey Daniel dey do, show sey e betta pass oda supavisors and ofisas. So bikos Daniel get betta wisdom, di king kon plan sey, make only Daniel dey in-chage of di whole kingdom. So di oda two men and di govnors kon dey find how dem go take trap Daniel, but dem nor si, bikos all wetin Daniel dey do, dey rite. So dem kon sey, “Wi nor go si anytin wey wi fit take whole Daniel, unless sey na sometin wey koncern en God.”
So dem go meet King Darius kon tell am, “Awa king! Make yu live forever! All of us wey dey rule yor kingdom, doz wey dey wosh wetin wi dey do; di kounselor, wise men and all di oda royal men, don gri sey make yu give orda kon back am with pawa sey, ‘For thirty days, anybody wey pray to any god or human being wey nor bi yu, make dem trow am for lions pit.’ Abeg, awa king, make yu give and sign dis orda, so dat nobody go fit shange am and e go bi like Mede and Persia Law wey nor dey shange.” So King Darius give and sign di orda.
10 Wen Daniel hear wetin happen, e kon go en house. E klimb go one room for up wey en window face Jerusalem. Just as e dey do before, e knee down for di window wey open kom pray give God and e dey do am three times evriday. 11 Wen Daniel enemies know sey e dey pray to God, 12 all of dem gada go meet di king kon tell am, “Awa king! Shebi yu sign orda sey for thirty days make anybody nor pray give human being or gods escept yu and yu sey who pray give any oda god, make dem trow am for lion pit?” Di king ansa, “Una dey korrect! E dey for Mede and Persia Law and dem nor go fit shange am.” 13 So dem tell di king, “Daniel, wey bi one of di pipol wey dem bring kom from Judah, nor gri respet di king orda at-all. Na three times a day, e dey pray give anoda God.”
14 Wen di king hear wetin dem tok, e nor happy and e kon try to save Daniel komot from dia hand. Until aftanoon dat day, e still dey find how e go take save Daniel. 15 Daniel enemies tell di king, “Awa king! Yu know sey Mede and Persian Law sey, any orda wey di king give, nobody go fit shange am.” 16 So di king sey make dem go trow Daniel for di lion pit. Di king tell Daniel, “Yor God wey yu dey serve evritime, go save yu!” 17 Dem remove di stone from di pit mout and di king put en own royal seal with en royal men own, so dat nobody go kom save Daniel. 18 Den di king go back to en palis. But for nite, di king nor fit chop, sleep or sey make dem play music for am.
God Save Daniel
19 As day just break, di king kon rush go di lion pit. 20 As e rish der, e kon shaut, “Daniel, God wey nor dey die savant! Di God wey yu dey serve fit save yu?”
21 Daniel kon ansa di king from di pit, “My king, yu go live forever! 22 My God send en angel kom klose di lion dem mout, so dat dem nor go tosh mi, bikos E si and know sey I nor do anytin. And I neva still do any bad tin to yu, my king.”
23 Di king kon dey happy, so e orda make dem bring Daniel kom out from di pit. Dem bring Daniel out from di pit and e nor get sore for body or any mark, bikos e bilive di God wey e dey serve. 24 Di king kon orda sey, “All di pipol wey lie for Daniel head, make dem katch dem, dia wifes and shidren kon trow dem for di lion pit.” Dem nor even rish groun before di lion dem bigin chop dem with dia bones.
25 King Darius kom rite give all di pipol, nashon and language wey dey di land sey: “I greet una! 26 I dey kommand sey, ‘Make evribody wey dey dis kingdom, fear and respet only Daniel God.’
“E go rule forever,
bikos E nor dey die.
Dem nor go fit distroy en kingdom
and en pawa nor get end.
27 E dey perform mirakle and wonders
for heaven and for dis eart,
E dey diliver and save pipol well-well.
E don save Daniel from lions mout.”
28 Wen Darius still dey rule for Babilon and Cyrus dey rule for Persia, Daniel kom prosper well-well.