5
Belshazzar Si Writing For Wall
King Belshazzar do party for en royal men wey rish 1,000 and e kon drink wine togeda with dem. As dem dey drink, King Belshazzar orda sey make dem bring all di gold, silva and bowl wey en papa Nebukadnezzar karry kom from God temple for Jerusalem. Di king sey make dem bring dem kom, so dat en, en ofisas, en wife and girl-friends go use dem drink wine. So, dem bring di gold cup and di bowl kom and dem use am take drink wine kon dey praiz dia god wey dem make with gold, silva, bronze, iron, wood and stone.
At wons, one finger appear kon dey rite for di palis wall near where di lamp for dey shine well-well and di king si di hand wey dey rite for di wall. Bikos e dey fear, en face kon dey red and all en body kon dey shake. Di king kon sey make dem go koll all di wise men, pipol wey dey si vishon and majishan kom. Den e tell dem, “If anybody fit read wetin dem rite for di wall kon tok wetin e mean, dem go wear am purpol royal garment kon gi-am gold shain wey get honor, den e go bi di nomba three pesin wey get pawa pass for dis kingdom.”
So di wise men kom, but dem nor fit read wetin dem rite or tell di king wetin e mean. Dat time, King Belshazzar kon dey fear well-well and shake anyhow, but en royal men nor even know wetin dem go do.
10 Bikos of di many nois wey dem dey make, di king mama enter di hall kon sey, “My king, yu go live forever! Abeg nor let dis tin shake yor mind and make yu nor fear! 11 E get one man for dis yor kingdom wey get di holy gods spirit inside am. Di time wey yor papa, Nebukadnezzar bi king, naim dey kommand all di wise men for Babilon. 12 E get one kind pawa with knowledge and wisdom. E dey solve problem wey pesin nor know. E go tell yu wetin dream or vishon mean; so make yu send for dis man, dem dey koll am Daniel wey di king shange en name to Belteshazzar and e go tell yu wetin di writing mean.”
13 So dem bring Daniel kom meet di king. Den di king ask am, “Na yu bi di Daniel wey my papa bring kom from Judah? 14 I don hear about yu; how di holy gods spirit dey inside yu and yor knowledge, wisdom and undastandin. 15 Si, dem bring di wise men and majishan kom here make dem read wetin dey di wall kon tell mi wetin e mean, but dem nor fit read am tok-less of to know di meaning. 16 Naw, I don hear sey yu dey fit tok meaning and esplain wetin pesin nor undastand. If yu fit read dis writing kon tell mi wetin e mean, yu go wear royal purpol; dem go put gold shain for yor neck and na yu go bi nomba three man for dis kingdom.”
Daniel Read And Tok Di Meaning
17 But Daniel ansa, “My king! Make yu keep yor gifts kon honor anoda pesin. But I go read wetin dey di wall kon tell yu wetin e mean. 18 Di Most High God make yor papa Nebukadnezzar get kingdom wey strong well-well and E give yor papa respet, honor and majesty. 19 Yor papa great well-well, sotey all di pipol, nashon and language dey shake and fear am. E dey kill who e won kill kon honor who e like honor or disgrace who e won disgrace. 20 But e kom dey karry body up, dey sturbon and pride kon full en spirit, so God remove am from en throne and e kom lost en respet. 21 Dem porshu am komot for where human being dey. En mind kom bi like animal own and e kon dey follow wiked donkeys dey stay. E dey chop grass like sey e bi melu kon dey sleep for bush and e nor get anytin to take kover en body from dew wey dey fall. Na so e bi until e kom bilive sey na God dey rule ova human being and dey give leadership to anybody wey E like.
22 “But yu, Belshazzar wey bi Nebukadnezzar pikin, neva gri respet God, even doh sey yu know all dis tins wey happen. 23 Instead, yu dey against God wey get heaven and eart. Yu bring all di tins from di temple, den yu and yor men, plus yor wife and yor girl-friends kon use dem dey drink wine. Yu dey praiz di gods wey dem make with gold, silva, bronze, iron, wood and stone; gods wey nor even fit si, hear or undastand! But yu neva ever praiz God wey dey kontrol yor life and ways! 24 Na dis make God send di hand kom rite all dis words for di wall.
25 “Dis na wetin di hand rite: MENE, MENE, TEKEL and FARSIN (E mean, NOMBA, NOMBA, WEIGH, DIVISION). 26 And dis na wetin e mean: mene (nomba) mean sey: ‘God don nomba di days wey yu go rule and E go end am.’ 27 Tekel (weigh) mean sey: ‘God don weigh yu for skale kon si sey yu dey lite.’ 28 Farsin (division) mean sey: ‘Dem go divide yor kingdom give Mede and Persia pipol.’ ”
29 Just as di king tok, dem kon wear royal purpol klot give Daniel; put gold shain for en neck kon make am di nomba three man for Babilon. 30 So for dat nite, dem kon kill Belshazzar wey bi Babilon king. 31 Darius wey bi Media pipol king kon take-ova di kingdom and dat time, e bi sixty-two years.