4
Nebukadnezzar Dream Again
King Nebukadnezzar send message go meet all di pipol for Babilon sey: “Make e betta for una! I dey happy to tell una di many signs and wonders wey God Almighty don do for mi.
“Di sign dem wey E show us dey great well-well!
Even en wonders dey mighty!
God kingdom go dey forever
and en pawa go last from awa generashon
go rish di next one.”
Nebukadnezzar Dream About Tree
Mi wey bi Nebukadnezzar dey live for peace for my palis, I dey enjoy betta tins. But I dream one bad dream wey make mi fear. Wetin I dey tink as I sleep for my bed and di vishon for my mind really make mi fear well-well. So I orda make dem koll all di wise men for Babilon, so dat dem go tell mi wetin di dream mean. Wen di majishan, pipol wey dey si vishon, wise men and odas kom, I kon tell dem di dream, but nobody among dem fit tell mi wetin e mean. Afta, Daniel (wey en name na Belteshazzar wey bi my god name and di holy gods spirit dey with) kon enter. So I tell am my dream sey: “Belteshazzar, na yu bi di majishan dem oga; I know sey di gods spirit dey inside yu and e nor get any dream or vishon wey yu nor know en meaning. I go tell yu my dream and yu go tell mi wetin e mean! 10 Dis na di dream wey I dream: Wen I dey sleep for nite, I si one tree wey dey di land centre.
11 “E tall rish di sky and yu go si am for anywhere wey yu dey for dis world. 12 Di tree leaf fine well-well and fruits wey go beleful evribody, full am. Wild animals dey stay under am and birds dey stay for en branches dem. Evritin wey God kreate, dey chop from am. 13 Wen I still dey tink about dis dream, I kon si one angel dey kom down from heaven. 14 E shaut kon sey, ‘Make una kut di tree kon distroy en branches; remove en leaf and skata en fruits. Make una drive di animal komot from under am and di birds wey dey en branches! 15 But leave di body for groun kon kover am with iron and bronze. Leave am for der with di grass; make dew wet am and make e stay with di animals and grass. 16 Make e stop to tink like human being. Make dem gi-am animal mind and e go dey like dat for seven years. 17 Dis na di decision wey di angel make. So, make evribody wey dey di world know sey di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E choose! Even to di pipol wey small pass!’
18 “Dis na di dream wey mi, King Nebukadnezzar dream. So Belteshazzar, make yu tell mi wetin di dream mean, bikos nobody among di wise men fit tell mi wetin e mean apart from yu, bikos di holy gods spirit dey inside yu.”
19 Den Daniel (wey en name na Belteshazzar) kon dey worry sotey e nor fit tok anytin. Di king kon tell am, “Belteshazzar, make yu nor let dis dream and en meaning worry yor mind.” Daniel ansa, “My king, e for betta sey dis dream na for yor enemy and wetin e mean, na for di pipol wey dey trobol yu! 20 Di tree wey yu si, wey grow big and strong rish heaven, wey dem fit si from any part for di world. 21 Tree wey get fine leaf and fruit wey go beleful evribody wey dey di world and where wild animals and birds dey stay, 22 na yu, my king! Yu don dey big and strong; yu don big sotey yu dey rish di heaven and yor pawa rish di end for di world. 23 For di dream, yu si angel kom out from heaven kon sey, ‘Make una kut and distroy di tree, but make una leave di body for groun. Make una kover am with iron and bronze. Make una leave am for der with di grass, so dat dew wey dey fall from di sky go wet am, den make e stay with animals for bush.’ ”
Daniel Tok Di Meaning
24 Dis na wetin e mean, “My king! Na wetin di Most High God tok, dey happen so. 25 Dem go drive yu komot from where human being dey stay and yu go stay with animals. Na seven years yu go take chop grass like melu and yu go sleep for open field where dew go fall for yor body, until yu go know sey na di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E like. 26 Wen dem sey make dem leave di tree body for groun, e mean sey dem go give yu back yor kingdom wen yu don know sey na God bi Oga of all ogas for dis world. 27 So, my king! Make yu follow my advise. Make yu turn from sin kom meet God; dey do good and sorry for poor pipol. Den yu go kontinue to prosper.”
28 So, all dis tins happen to King Nebukadnezzar. 29 Afta twelf monts, as e dey waka for di roof for en palis for Babilon. 30 E kon sey: “Dis nor bi di great Babilon wey bi di royal town wey I build by mysef to show my pawa, strent, glory and honor?” 31 As e still dey tok, one vois kom from heaven kon sey: “King Nebukadnezzar, make yu hear wetin I dey tok, God don komot yor kingdom from yor hand! 32 Dem go drive yu komot from where human being dey and yu go stay with animals. Na seven years yu go take chop grass like melu kon sleep for open field where dew go fall for yor body, until yu go know sey na di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E like.”
33 So, di word wey God tok about Nebukadnezzar kon happen. Dem drive am komot from where human being dey and e kon go stay with animals. E chop grass like melu for seven years and dew fall for en body, until en hair kon long like eagle feada and en finger long like bird own.
34 But wen di seven years don pass, mi, Nebukadnezzar kon look heaven and my sense kom back to mi.
I praiz di Most High God
kon give honor and glory
to di Pesin wey dey live forever
and en kingdom go last forever.
35 Yu nor fit kompare God
with anybody for dis world.
E dey do wetin E like with di angels for heaven
and pipol for dis world.
Nobody fit shalenge or ask am,
“Wetin Yu tink sey Yu dey do?”
36 Wen my mind don kom back to mi, dem kon give mi back my kingdom, pawa and glory. My ministers and royal men welkom mi back and dem give mi my royal pawa and di honor wey I kom get, big pass di first one. 37 Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.