21
Dem Kill Saul Grand-shidren
Wen David bi king, strong honga kon dey and e last for three years. So David ask God and E ansa am sey, “Saul and en family dey guilty, bikos dem kill pipol. Dem kill Gibeon pipol.”
Gibeon pipol nor dey join Israel pipol; dem bi small tribe for Amor wey Israel pipol promise sey, dem go protet, but Saul don try to distroy dem, bikos of en love for Judah and Israel pipol. So David koll Gibeon pipol kon tell dem, “Wetin I go fit do for una? I won do good for di bad tins wey dem don do una, so dat una go bless God pipol.”
Dem ansa, “Di kworel wey wi get with Saul, dem nor fit setol am with silva and gold and wi nor won kill any Israel pesin.”
So David ask dem again, “Wetin una wont make I do for una?”
Dem ansa, “Saul won distroy all of us komot from Israel. So make yu give us seven of en grand sons and wi go hang dem give God for Gibeah, wey bi Saul, di king wey God choose town.”
Di king ansa, “I go give una.”
But bikos of di holy promise wey en and Jonatan don make give diasef, David nor kill Jonatan pikin wey dem dey koll Mefiboshet, wey bi Saul grand-pikin. But e take Armoni and Mefiboshet, di sons wey Rizpah born for Saul and na Aiaya bi Rizpah papa. E still take Saul dota, Merab five sons; den Barzillai wey kom from Meholah, di king take en pikin, Adriel. David give dem to Gibeon pipol and dem kon hang dem give God for di mountin. Dis tin happen before dry sizin start and dem won start to harvest barley.
10 Den Saul girl-friend, Rizpah, wey Aiaya born kon use sak klot take make house for ensef for where di dead body dem dey and e stay der from harvest time go rish wen heavy rain start to fall. E go drive birds komot from di dead body for day time kon keep dem from bad animal for nite. 11 Wen David hear wetin Rizpah do, 12 e kon go kollect Saul and Jonatan en pikin bones from Jabesh pipol for Gilead. (Dem bin karry dem form Bet-Shan for where dem hang dem put afta Filistia pipol kill Saul for Mount Gilboa.) 13 David karry Saul, Jonatan and di seven men wey dem hang bones, 14 den e beri Saul and Jonatan bones for Saul papa, Kish, grave for Zela wey dey Benjamin aria and di pipol do evritin wey di king kommand. Afta evritin wey dem do, God kon ansa Israel pipol prayer.
War Against Filistia Pipol
15 Israel and Filistia pipol bigin fight again, so David with en men go fight dem. As dem dey fight, David kon taya well-well to fight. 16 One giant wey dem dey koll Ishbi-Benob, wey karry bronze spear wey heavy rish seven and half pounds with new swod kon tink sey e fit kill David. 17 But Abishai, Zeruaya son, run kom help David attack di giant kon kill-am. Den David men kon sey make David promise dem sey e nor go follow dem go fight war again. Dem sey, “Na yu bi di hope wey Israel get and wi nor won luz yu.”
18 Afta dat one, dem fight with Filistia pipol for Gob and Sibbekai wey kom from Hushah kill one giant wey dem dey koll Saf.
19 Dem still fight with Filistia pipol for Gob again and Elhanan, Jair pikin wey kom from Betlehem kon kill Goliat wey kom from Gat. En spear mout tick rish di shaft wey dem take dey weave klot.
20 Dem fight again for Gat and e get one giant for der wey like fight well-well. E get six finger for en hand and leg. 21 E trobol Israel pipol well-well, so Jonatan wey bi David broda Shimei pikin kon kill-am.
22 Dis four men na Gat giant grand-shidren and na David and en men kill dem.