20
Sheba Fight
E get one man for Gilgal wey dem dey koll Sheba, na Bikri bi en papa wey kom from Benjamin tribe. E blow trumpet take koll di pipol kon sey,
“Make David get out!
Wi nor go follow am again!
Israel men, make wi dey go awa house!”
So Israel pipol leave David kon follow Sheba, but Judah men obey and follow David from Jordan River go Jerusalem.
Wen David rish en palis for Jerusalem, e take en ten girl-friends wey e leave make dem kare for di place kon sey make dem guide dem. E give dem evritin wey dem wont, but e nor sleep with dem. And still dem die, e keep dem like wimen wey dia husband don die.
Di king tell Amasa, “Make yu koll all Judah men kom meet mi di day afta tumoro.” So Amasa go koll dem, but e nor kom back wen di king sey make e kom.
So di king tell Abishai, “Sheba go give us wahala pass Absalom. So make yu take my men go fine am or e go enter some town wey dem dey guide well-well kon run from us.” So Joab men, di king bodyguard and all di oda sojas komot from Jerusalem with Abishai go find Sheba.
Wen dem rish di big rock for Gibeon, Amasa kon si dem. Joab wear en war klot kon tie e swod with en belt. As e waka go front small, en swod kon fall.
Joab kon tell. Amasa, “My friend, how yu dey?” E kon hold en hair with en rite hand like sey e won kiss am. 10 Amasa nor protet ensef against di swod wey Joab hold for en oda hand, so Joab shuk am for belle and en intestine kom out. Amasa just die at wons and Joab nor nid to shuk am again. Den Joab and Abishai, en broda kon go find Sheba.
11 One of Joab men stand near Amasa dead body bigin shaut, “All di pipol wey dey Joab and David side, make una follow Joab!” 12 Amasa body dey di road centre and en blood spread around am. Wen Joab men si sey evribody dey stop wen dem si di body, dem drag di body enter di bush korna kon kover am with klot. 13 Wen dem don remove di body from di road, evribody kon follow Joab porshu Sheba.
14 Sheba run pass all Israel pipol aria go Abel-Bet Maaka town and all di pipol for Bikri village gada follow am enter di town. 15 Wen Joab men hear sey Sheba dey der, dem kon build tick wall round di town, so Joab men kon bigin dig di wall so dat e go skata fall. 16 E get one woman wey get sense well-well for di town, so e shaut from di wall sey, “Make una listin! Make una listin! Make una tell Joab make e kom here, bikos I won tok to am.” 17 Joab go meet am and di woman sey, “Na yu bi Joab?”
E ansa, “Yes, na mi.”
E sey, “My oga, make yu listin to mi.”
Joab ansa, “I dey listin.”
18 Di woman sey, “Before-before, dem bi dey sey, ‘Go get yor ansa for Abel town’ and dat na di only tin wey dem sabi do. 19 Awa town na big one wey get peace and pipol dey respet us for Israel. Why yu won distroy am? Yu won skata wetin bi God own?”
20 Joab ansa, “No o-o! I nor go fit distroy una town! 21 Nor bi awa plan bi dat. One man wey dem dey koll Sheba wey bi Bikri pikin, wey kom from Efraim hill kountry, naim start di fight with King David. If una bring dis man kom out, I go leave una town.”
Di woman kon sey, “Wi go trow en head pass di wall kon give una naw-naw.”
22 Den e go meet di town pipol with en plan, so dem kut Sheba head kon trow am go give Joab for di oda side for di wall. Joab blow en trumpet take tell en men sey make dem leave di town and dem kon go house go meet di king for Jerusalem.
23 Na Joab dey kommand Israel pipol soja, while Benaya wey bi Jehoiada pikin dey kontrol David bodyguard. 24 Adoniram dey kontrol doz wey dey work and na Jehoshafat wey bi Ahilud pikin, dey keep di rekord. 25 Na Sheva bi di kourt seketry, while Zadok and Abiatar na priests 26 and Ira wey kom from Jair town still dey among David priests.