8
Holy Spirit Life
So, God nor go kondemn pipol wey bilive Jesus Christ. Since di Holy Spirit don give una life wey kom from Jesus Christ, e go free una from sin and deat. Moses Law nor fit do dis tins, bikos di yeye life wey wi dey live don make di law weak. But God don free us wen E send en pikin kom like human being wey bi sina, make e for sakrifice ensef for awa sins. God do so, so dat wetin di law tok, go happen wen wi obey di Spirit, instead of awa own mind.
Bikos pipol wey dey live by dia own mind, dey tink of only demsef. But evribody wey di Holy Spirit dey rule, dey tink of tins wey di Spirit wont. If wi let sin rule awa mind, wi go die. But if na di Spirit dey rule us, wi go get life and peace. Pipol wey dey sin, na God enemy dem bi, bikos dem nor obey en law, since dem nor fit obey am. Doz wey dey obey sin, nor go fit make God happy. But una nor dey obey sin, instead, na as di Spirit sey make una live, na so una dey live. 10 Christ dey live inside una. So una dey alive, bikos God don asept una, even doh una body must die, bikos of una sins. 11 If God Spirit wey raiz Jesus Christ from deat dey inside una, den en wey raiz Christ from deat, go give una body life, bikos of en Spirit wey dey inside una.
12 So my brodas and sistas, wi get work to do for God, so make wi nor live as awa body wont. 13 Bikos if una dey follow sin, una go die. But di Spirit pawa go kill all di bad tins wey una dey do, so dat una go get life. 14 Na doz wey God Spirit dey lead, bi God shidren. 15 Di Spirit wey God give us nor go make us fear like slave, instead, wi bi God shidren and wi dey koll am, “Awa Papa!” 16 Na God Spirit make us know sey wi bi God shidren. 17 And if wi bi God shidren, den wi go inherit God propaty. Yes, wi go follow Christ inherit God propaty, bikos if really wi sofa with am, wi go follow am enjoy.
Glory For Front
18 I dey sure sey, wi nor go fit kompare all di sofa wey wi dey sofa naw, with di glory wey God go give us. 19 Evritin wey God kreate for dis world, dey wait for God to show en shidren to di world. 20 Bikos of sin, di world dey sofa from God curse naw and nor bi bikos dem wont am like dat. But di world dey hope 21 sey one day, God go free dem from deat and wahala and dem go-go join en shidren wey E don save. 22 Wi know sey evritin wey God kreate, dey kry, just like di way woman wey won born dey kry. 23 Di Holy Spirit don make us dey sure of how tumoro go bi. But naw, wi dey struggol as wi dey wait make God show sey wi bi en shidren, den E go kon save us. 24 Na dis hope save us. But if wi don already get wetin wi dey hope for, den wi nor nid to dey hope again. Abi who dey hope for wetin e don already get? 25 But if wi put hope for wetin wi nor fit si, wi go take all awa mind wait for am with patient. 26 Na so too di Holy Spirit dey help us bikos wi dey weak. Bikos wi nor know wetin wi suppose to pray for, di Spirit by ensef dey kry beg God, for di way awa word nor go fit esplain. 27 And God wey dey si evritin inside awa belle, know wetin dey di Spirit mind, bikos di Spirit dey pray for all God pipol, as God wont.
28 And wi know sey evritin dey work for awa good, bikos wi love God and dey do wetin E wont. 29 God know doz wey E don choose, so E don make dem bi like en Pikin, so dat en pikin go bi di first-born. 30 Doz wey God don asept, na dem E koll; doz wey E koll, na dem E make raitious and E kon share en glory with dem.
31 Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us? 32 True-true, if E let dem kill en own pikin for awa sins, den E go fit give us evritin wey wi ask from am free of sharge! 33 Who go fit akuiz pesin wey God don choose? Na God know who good or bad. 34 Who bi di pesin wey go kondemn us? Na Jesus Christ wey die for us; di pesin wey God raiz from deat and naw, e dey for God rite hand side dey pray for us. 35 Na who go fit separate us from Christ love? Na trobol or opreshon; honga or poverty; wahala or deat; or na bikos klot nor dey to wear? 36 As dem rite am, “Bikos of una, wi dey face deat from morning go rish nite and wi bi like sheep wey dem won go kill.” 37 Inside all dis tins, awa joy don dey full, bikos Jesus love us! 38 But I dey sure sey, weda na deat or life; angels or wiked pawas; tins wey dey naw or di ones wey dey kom; 39 tins wey dey heaven; tins for under dis eart or anytin wey God kreate, non of dem go fit separate us from God love, bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.