7
Law Pawa
My brodas and sistas, I know sey I dey tok to pipol wey know di law. Na only wen pesin still dey for life, naim di law dey get pawa for en body. As di law tok, woman wey don marry dey under en husband as long as di man dey alive. But if di man die, di woman don free. So if woman marry anoda man wen en husband still dey alive, e mean sey e don kommit adultery. But if en husband die, e don free from wetin di law tok and e go fit marry anoda man again. So my brodas and sistas, na so e bi with una too. Una don bikom part for Jesus Christ body and una don die to di law pawa. Naw, una dey free to bi Christ own; di pesin wey God raiz from deat make una for dey serve am. Wen wi still dey di world, di law dey make us do bad tins wey awa body wont and all dis tins dey bring deat. But naw, wi don free from di law. Wi bi like deat body and di law nor get pawa for awa body again. Naw wi suppose to serve God with di new life wey di Spirit dey give, nor bi di old life, wey bi to obey di law wey pesin rite.
Law and Sin
Dis mean sey di law nor good? No! But na di law make mi know wetin sin bi. If to sey di law nor sey, “Nor get long-trot for anoda man tin,” I nor for know sey I nor suppose to do dat kind tin. But bikos of di law, di sin pawa wey dey inside mi kon dey make mi tink about tins wey nor good and if law nor dey, sin for nor get pawa for my life. Before I know di law, I dey alive, but wen I hear God kommandment, sin just enter my life 10 and I kon die. So di law wey suppose give mi life, don kill mi! 11 Since sin pawa use di law deceive mi, I kon die. 12 But di law dey holy, rite and good.
13 So dis mean sey na wetin good kill mi? No! But na sin pawa wey dey inside mi, na-im kill mi; bikos e use wetin good bring deat and naw, wi dey si how sin bad and wiked rish. 14 Wi know sey di law dey spiritual. But I bi human being and dem don sell mi give sin. 15 I nor undastand wetin I dey do; bikos I nor dey do wetin I won really do. Instead na wetin I nor like, I dey do. 16 Since I dey do wetin I hate to do, e show sey di law dey korrect. 17 Nor bi mi really dey do wetin I dey do, but na di sin pawa wey dey inside mi. 18 I know sey wetin dey inside mi nor go let mi do good. Even wen I won do good, I nor dey fit. 19 Instead of make I do wetin dey good, na bad tins I dey do. 20 So if I do wetin I nor won do, e show sey nor bi mi dey do am again, but na di sin pawa wey dey inside mi. 21 So I si sey dis law dey work, bikos wen I won do good, na only bad tins dey enter my mind. 22 I dey like to obey God law with my whole mind, 23 but inside mi, I kon undastand sey sometin dey fight against my mind and e dey make mi bi sin savant, bikos e dey kontrol my body. 24 I nor dey happy at-all! Who go save mi from dis body wey dey push mi go die? 25 Tank God! Jesus Christ don save mi. So, I go obey God law with my mind, even doh sin pawa still dey inside mi.