5
Peace And Joy
Since faith don make us dey good for God eye, wi don get peace thru awa Oga God Jesus Christ. Na faith e take buy us so dat wi go enter God grace, di place where wi dey naw. So wi fit boast with God glory wey wi dey enjoy. Wi still dey happy inside di wahala wey wi dey face, bikos wi know sey trobol go make us endure, and endurance dey bring good karata, wey go make us get hope. Dis hope nor dey disappoint pesin at-all, bikos God pour en love like river wey dey flow inside awa heart, thru di Holy Spirit wey E give us.
For di time wen wi nor fit help awasef, Christ kon die for us wey bi sinnas. Nobody go won die for anoda pesin wey dey good for God eye, aldo somebody go fit die for pesin wey good well-well. But God show how en love for us big rish, wen E send Christ kom die for us, even doh wi still dey sin. Naw, wi dey rite bikos of Christ blood and na dis blood go save us from God vexnashon. 10 Wi bi God enemies before, but E don make us en friends thru en Pikin deat. Naw, since wi don bi God friends, E go save us thru di life wey en pikin get. 11 Nor bi only dis won make us dey happy, but wi still dey happy bikos of wetin God don do thru awa Oga God Jesus Christ wey make us bi God friends.
Adam And Jesus Christ
12 Na thru one man sin enter dis world and deat kom thru sin. So wi must die, bikos evribody don sin. 13 Sin dey di world before di law kom, but if law nor dey, wi nor go fit judge pipol sin. 14 From Adam kon rish Moses time, na deat dey rule for dis world, even doh nor bi evribody disobey God kommand like Adam. Dis Adam bi like Christ wey kom leta. 15 But two of dem nor bi di same, bikos God free gift nor bi like Adam sin. Na true sey many pipol die bikos of one man sin. But God grace big well-well and e dey give free gift to pipol thru en pikin Jesus Christ! 16 God gift and one man sin nor bi di same. Judgement follow di one man sin kon kondemn evribody, but na God gift dey free us, even doh wi bi sinnas. 17 But if na bikos of one man sin deat kill evribody, den, doz wey don get favor and Christ gift, dey good for God eye and dem go enjoy life thru Jesus Christ!
18 God go ponish evribody bikos of Adam sin. But bikos of di good tins wey Jesus do, God don asept and give us di gift wey dey give life. 19 Bikos Adam nor obey God, many pipol bigin sin. But since Jesus obey God, many pipol go obey God too. 20 Di law kom so dat sin go inkrease, but where sin get pawa, God grace strong pass am 21 and as sin dey kontrol us thru deat, na so God grace dey rule thru raitiousness wey dey bring life wey nor dey end bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.