20
David Katch Rabbah
Di next rainin sizin, for di time wen kings dey go fight, Joab karry en sojas go skata Ammon land; but David stay for Jerusalem. Dem attack, distroy and seize Rabbah town. Ammon pipol juju wear one gold crown for en head wey heavy rish 75 pounds and jewel dey inside am, so David kollect am put for en own crown. E still karry many tins komot from di town. E karry di town pipol kon make dem work with saw, iron hoe and axe. Na so e do with di odas for all di towns for Ammon. Den en and en men, go back to Jerusalem.
Fight Against Filistia Pipol
Afta, Israel pipol kon fight again with Filistia pipol for Geza. For dis time, Sibbekai from Hushah kill one giant wey dem dey koll Sippai and dem kon win Filistia pipol.
Dem still fight with Filistia pipol and Elhanan wey Jair born, kill Lahmi wey bi Goliat broda from Gat wey e spear tick rish di bar wey dem take dey weave.
Anoda fight happen for Gat, where e get one giant wey get six fingers for en hand and six toe for en leg. Na di giants family for Gat, e from kom. E dey trobol Israel pipol, but na Jonatan wey David broda, Shimea born, kill-am.
All dis men na giant, Rafa shidren-shidren for Gat and na David with en men, kill dem.