19
David Win Ammon Pipol
Leta, King Nahash for Ammon die and en pikin Hanun kon take-ova from am. King David sey, “I must go pay respet and make friend with King Hanun, just as King Nahash wey bi en papa, do give mi.” So David send messenjas go tell am sorry for en papa wey die.
Wen David messenjas rish King Hanun palis for Ammon, doz wey bi leaders for Ammon kon tell di king, “Yu tink sey na, bikos of yor papa wey die naim make David send dis pipol kon tell yu sorry? Wi know sey e send dem kom look di land, so dat leta, e go kom fight and win us!” So King Hanun hold David messenjas, kut dia bear-bear and di klot for dia yansh side kon send dem go back.
Shame nor let dem go house back. Wen King David hear wetin happen, e send message go meet dem sey make dem stay Jeriko until dia hair grow again.
Wen King Hanun and Ammon pipol know sey dem don make David dia enemy, dem kon use about 75,000 pound for silva take go hire men from Aram Naharaim, Aram Maaka and Zobah. Di 32,000 shariot wey dem hire and Maaka sojas kon kamp near Medeba. All Ammon pipol ready kom from dia town to fight.
Wen David hear wetin happen, e kon send Joab with all en sojas go. Ammon pipol mash go pozishon for di side wey dem take dey enter Rabbah wey bi dia kapital town and all di kings wey kom help dem, dey for di open field.
10 Joab si sey dia enemy sojas go attack dem from both front and back, so e choose di strong-strong sojas for Israel kon make dem face Aramean pipol. 11 E kon sey make en broda, Abishai, dey kommand di oda sojas and dem kon face Ammon pipol.
12 Joab tell Abishai, “If yu si sey Aramean pipol dey opress mi, make yu kom help mi and if Ammon pipol dey opress yu, I go kom help yu. 13 Make yor heart dey strong! Make wi fight for awa pipol and God town and make God do wetin dey en mind.”
14 Wen Joab with en pipol attack, Aramean pipol kon bigin run. 15 Wen Ammon pipol si Aramean pipol dey run, dem too kon start to run from Abishai go inside dia town. Den Joab and en sojas kon go back to Jerusalem.
16 Wen Aramean pipol si sey Israel pipol don win dem, dem kon send for more men from di east side for Eufrates river and na Shobak wey dey kommand Hadadeza soja for Zobah, bi dia kommander.
17 Wen David hear am, e gada Israel sojas, cross Jordan River kon face Aramean pipol and dem kon start to fight. 18 Israel pipol kon porshu Aramean sojas go back. David with en men kill 7,000 shariot drivers and 40,000 sojas wey dey waka with leg. Dem still kill Shobak wey bi Aramean sojas kommander.
19 Wen di kings wey dey respet King Hadadeza si sey Israel pipol don win dem well-well, dem kon go make peace and bigin obey King David.
So Aramean pipol nor gri kon help Ammon pipol again.