17
God Promise David
Wen King David don dey stay en palis, e kon tell Profet Natan, “I dey stay for palis wey dem build with cedar wood, but God Kovenant Box dey for tent!”
Natan ansa, “Make yu do wetin dey yor mind, bikos God dey with yu.”
Dat nite, God kon tell Profet Natan,
“Go tell David my savant sey, ‘Dis na wetin God dey tok: “Make yu nor build house for mi. Bikos since di time wen I take Israel pipol komot from Egypt kon rish naw, I neva stay for any house. Na difren tent I dey stay for evriwhere. Even as I travel with Israel pipol rish, I neva tell any leader wey I put before sey, ‘Wetin make yu neva build temple for mi with cedar wood!’ ” ’
So, make yu tell David my savant sey, mi wey bi di Oga God sey, ‘I take yu from where yu dey guide sheep kon make yu lead my pipol, Israel. I dey follow yu go anywhere wey yu dey go kon let yu win all yor enemies. I go make yu dey popula like all di strong men for dis eart. I don choose one place for my pipol, Israel and I don put dem for where dem go stay and nobody go opress dem again as dem dey do dem before-before 10 wen I choose pipol to dey judge dem. I go distroy all yor enemies.’
I pray sey, ‘Mi di Oga yor God go give yu many shidren wey go bi kings. 11 Wen time don rish for yu to die, I go make one among yor pikin, king kon make en kingdom strong. 12 Na-im go build temple for mi and I go make sure sey en kingdom dey forever. 13 I go bi en papa and e go bi my pikin. I go always support am and I nor go leave am as I leave Saul wey yu take-ova from. 14 I go make am rule my pipol and my kingdom forever; en shidren-shidren go always dey rule.’ ”
15 So Profet Natan go tell David evritin wey God tell am.
David Praiz God
16 So David enter Tabanako, sidan kon sey,
“My Oga God! Na who bi mi and my family wey Yu dey do all dis tins for? 17 Yu even do di ones wey big pass dis ones! Even my grand-grand shidren wey dem neva born, Yu don promise dem many tins! My Oga God! Why Yu dey trit mi like one big man?
18 Wetin I won tell Yu again? Even doh Yu know mi well-well, Yu still dey respet mi wey bi yor savant. 19 Yu dey do all dis tins for mi yor savant, bikos na so Yu wont am. Yu don show mi how Yu big rish.
20 My Oga God! Nobody bi like Yu! Wi know sey na only Yu bi God. 21 No kountry for dis world bi like Israel pipol wey Yu save from doz wey opress dem kon make dem yor pipol. Di big tins wey Yu do for dem, don make pipol know yor name for di whole world. Yu save yor pipol from Egypt kon drive oda pipol komot from di land for dem. 22 Yu don turn Israel to yor pipol forever and na Yu wey bi God, bi dia God.
23 Naw, my Oga God, make Yu do wetin Yu promise my shidren-shidren! Make Yu do wetin Yu sey Yu go do. 24 Dem go know yor name, den pipol go always dey sey, ‘God Almighty na Israel pipol God’ and Yu go always keep my kingdom.
25 My Oga God, I dey pray with all my heart, bikos Yu don show and tell yor savant sey, ‘I go make yor shidren-shidren rule forever.’ 26 My Oga God! Yu bi God and Yu don promise mi all dis wonderful tins. 27 And naw, Yu don choose to bless my family so dat wi go dey with Yu forever, bikos if Yu my God bless pesin, di blessing go dey forever.”