16
David Start Di Woship
Dem karry di Kovenant Box go put for di tent wey David make for am. Den dem do sakrifice kon woship God. Afta David don give di sakrifice finish, e kon bless di pipol with God name and all of dem kon chop beleful. E give bread, meat wey dem roast and rice to each pesin for Israel.
David tell some Levi pipol sey, make dem lead di pipol as dem dey woship for di Kovenant Box front kon dey sing and praiz di Oga wey bi Israel pipol God. Dem sey make Asaf lead dem, while Zekaraya go dey help am. Den make Jeiel, Shemiramot, Jehiel, Mattitaya, Eliab, Benaya, Obed-Edom and Jeiel play harp, while Asaf go dey play di cymbal. Na Priest Benaya and Priest Jahaziel dey blow di trumpet for di Kovenant Box front.
David Tank God
Dat day, David first sey make Asaf with all Levi pipol sing dis song take tank God:
“Make una tank and koll God name!
Make una let di whole world know di tins wey E do!
Make una sing dey praiz God!
Make una tok about di wonderful tins wey E dey do!
10 Make una boast about en name wey dey holy!
Doz wey dey serve am, make una happy!
11 Make una go meet God and E go help una!
Make una always dey woship am!
12 Make una remember all di mirakles wey E do,
en wonderful works and di way E take dey judge,
13 bikos na una bi Israel shidren-shidren; God savant;
pipol wey kom from Jakob wey God don choose as en own!
14 Na-im bi di Oga awa God!
Na-im dey judge di whole eart.
15 Make una nor forget wetin dey God kovenant;
en kovenant wey go last forever,
16 just as E promise Abraham and Isaak.
17 God give en kovenant to Jakob
and na kovenant wey go last forever.
18 E sey, ‘I go give yu Kanaan land
and e go bi yor own.’
19 Dat time, God pipol nor many
and dem bi strenjas for di land.
20 Dem dey waka from kountry to kountry
and from town to town.
21 God nor let anybody opress dem;
instead, E ponish kings bikos of dem kon sey:
22 ‘Make una nor tosh di pipol wey I choose
or trobol my profets.’
23 Make evribody for di eart sing to God!
Make una always dey tok about en goodness
and how E take dey save pesin.
24 Make una tell di world about en glory
and di big-big tins wey E dey do.
25 Bikos God dey great and evribody must praiz
and respet am pass oda gods.
26 Di gods for oda towns nor mean anytin,
but na God make di heavens.
27 Na-im get glory and majesty!
Na-im dey give us pawa and joy.
28 Make evribody praiz God!
Make una praiz God for en glory
and how E big rish.
29 Make una give God di praiz
wey bi en own!
Make una bring ofrin kom en present!
Make una dey holy kon woship God!
30 Make evritin wey dey dis world fear God!
God don make di world stand
and nor-tin go fit move or break am.
31 Make di heavens and eart dey happy!
Make una tell di whole world sey, na God bi king.
32 Make di sea and evritin wey dey inside, shaut!
Make di grass and evritin wey dey inside dem bigin dance!
33 Den make all di trees for bush shaut with joy for God,
bikos E dey kom judge di world.
34 Make una tank God, bikos E dey good,
en love go dey forever.
35 Make una pray kon sey,
‘Awa Oga God, make Yu kom save us!
Make Yu gada us kon save us from dis nashons!
Den wi go tank and praiz yor name wey dey holy.’
36 Make di Oga wey bi Israel God get all di praiz
from naw and forever.”
Den all di pipol ansa, “Amen! Wi go praiz di Oga awa God!”
Woship For Jerusalem and Gibeon
37 King David sey make Asaf and some Levi pipol dey lead di pipol as dem dey woship God for di tent where di Kovenant Box dey and na der dem go for dey do dia work evriday. 38 Dem still choose Obed-Edom wey bi Jedutun pikin and 68 oda men. Na Hosah and Obed-Edom dey guide di gate.
39 Na Priest Zadok and di oda priests dey serve for God house for Gibeon. 40 Evry morning and evening, dem dey offa burnt sakrifice for di altar, just as dem rite am for God Law Book. 41 Odas wey join dem na: Heman, Jedutun and di odas wey dem choose to dey praiz God, “Bikos en love dey forever.” 42 Na Heman and Jedutun dey kontrol how dem dey play di trumpets, cymbals and di oda tins wey dem take dey praiz God. Na Jedutun sons dey guide di gate.
43 Den evribody go back to en house and David go en house too go bless en family.